Bitcoin Forum
June 01, 2024, 06:29:34 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: « 1 [2]  All
  Print  
Author Topic: When Godfather-ism becomes a problem in Nigeria  (Read 223 times)
Miles2006
Full Member
***
Online Online

Activity: 266
Merit: 163


View Profile
November 11, 2023, 02:32:39 PM
 #21

Wetin you talk na true, this thing dey common for everywhere na why anytime them wan leave the seat them dey like put their brother or godson. But sometimes I like this godfatherism because na who get godfather go enjoy the benefit just like if you get godfather wey be governor at least you sef go benefit, but in this case of wike and Joseph Fubara fight, many reasons fit dey but as we no know the cause make we no just dey follow all this bloggers dey predict for me Wike never come out talk, Fubara never come out talk the issue but every body dey suspect say na oppression, wike has ruled river state for eight good years and at a point I called Wike the best governor in Nigeria, bro, the guy dey do project like ehh Wike really try for river state most especially the capital so wetin be the oppression for? Wetin wike dey tell am to do wey he no wan do? Although some people like to do there own things there own way regardless of anyone.
Firstly this thing dey common for Nigeria and e good make godson obey he godfather. Wike for no just choose Fubara if he no agree to the terms and condition, If not of Wike I no sure say Fubara for dey that seat so since he agreed to what Wike said he should bear it rather than fighting the one that gave him the power. All this one na why Nigeria go dey backward, this one no be lie ooh even my state dey suffer from this nonsense wey them call godfathrism and godson, anything godfather talk godson go listen. Fubara should just obey rather than causing chaos in the state
Majestic-milf (OP)
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 826
Merit: 596



View Profile
December 13, 2023, 08:04:22 AM
 #22

 I no know if nah only me dey hear say them wan scatter Rivers State House of assembly. I dey hear now say as at time of writing, bulldozers dey the Rivers State House of assembly dey scatter the building and I dey wonder why this thing dey happen. The last time we hear such news about that place, we know say nah fire catch the building and as e be, dem dey scatter am and I dey ask whether as nah government property, them no suppose give update to the public? Or the incumbent Governor dey aware of this thing wey dey shele so? I no understand o.

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBIT
  CRYPTO   
FUTURES
 1,000x 
LEVERAGE
COMPETITIVE
    FEES    
 INSTANT 
EXECUTION
.
   TRADE NOW   
Sexylizzy2813
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 588
Merit: 422



View Profile
December 14, 2023, 12:40:13 AM
 #23

I no know if nah only me dey hear say them wan scatter Rivers State House of assembly. I dey hear now say as at time of writing, bulldozers dey the Rivers State House of assembly dey scatter the building and I dey wonder why this thing dey happen. The last time we hear such news about that place, we know say nah fire catch the building and as e be, dem dey scatter am and I dey ask whether as nah government property, them no suppose give update to the public? Or the incumbent Governor dey aware of this thing wey dey shele so? I no understand o.

Politics for this our contri no be wetin person wey get BP suppose follow, as them dey do their thing, we don dy hear all the kata kata wey them dy do but if nah where them go enter go enjoy smile and share money you no go hear am.
I hear the news but I no too put interest becos na wetin me I expect after that crazy protest, this one nah just to show say the state no be one governor dy run am, we get 2 in 1 governor like this.
If this current governor no wan play to the tune of the past governor nah so problem go dy happen for the state and all these things nah to let Mr SIM know say him suppose obey the last command if not nah to remove am from that sit.
Today nah house of assembly tomorrow fit be government house so make we dy watch and see.

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBITCRYPTO
FUTURES
[
1,000x
LEVERAGE
][
.
COMPETITIVE
FEES
][
INSTANT
EXECUTION
]██████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██████
████████████████████████████████████████████████████████
.
TRADE NOW
.
████████████████████████████████████████████████████████
██████
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██
██████
Y3shot
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 616
Merit: 171

Bitcoin👌 or nothing


View Profile
December 14, 2023, 07:36:34 PM
 #24

I no know if nah only me dey hear say them wan scatter Rivers State House of assembly. I dey hear now say as at time of writing, bulldozers dey the Rivers State House of assembly dey scatter the building and I dey wonder why this thing dey happen. The last time we hear such news about that place, we know say nah fire catch the building and as e be, dem dey scatter am and I dey ask whether as nah government property, them no suppose give update to the public? Or the incumbent Governor dey aware of this thing wey dey shele so? I no understand o.
According to the government dem say the fire incident wey been happen for the house of assembly expert advice the government say the building is now not good for people to stay inside , and this something that needs to be handled very fast.  You see all this talks na just excuse wey the rivers state government they use cover up. The demolition of the building is more of politics , which we know some days ago majority of the house defect to the winning party.
Pages: « 1 [2]  All
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!