Nor be just about to know about bitcoin but na where u take learn about bitcoin from and wetin dem tell you about am. Becos how these young Nigerians go take plan to kidnap themselves come dey ask one of them papa for 50 million Naira in Bitcoin but when the papa send 5 million Naira in Bitcoin, them blow 2 million. This make me summarize say nor be just know about bitcoin but who you learn bitcoin from and wetin dem tell you exactly about bitcoin. Obviously these Nigerians get they misguided about bitcoin.
E Dey pin me when I see things like this, because na people like dis Dey spoil d reputation of bitcoin, sometimes you go see people wey Dey into yahoo Dey talk say na bitcoin dem Dey into, things like that just Dey fucking annoying. The father wey pay 5 million in bitcoin no fit every believe say dem fit use bitcoin for any better thing again, him go Dey reason say na only illegal things dem fit use bitcoin for, and people like this will never believe in bitcoin again.
Seriously dem suppose punish the criminals wey do that thing, how you go kidnap yourself come Dey request for ransom, e no really make any sense to me now, and even d money wey dem collect na rubbish dem go use am do, na waste dem go still waste am, and they don put tension for there father body, and Dey don spoil bitcoin reputation again.
When we dey talk to young people about bitcoin make we tell say:- bitcoin nor be for getting rich quick
- nor be about how many bitcoin you get but how you take get am. If you get am through legit means you go appreciate am and get peace of mind but if you get am through illegal means you go dey fear make dem police nor catch you one day and na to squander am because you feel say you go always fit get am through that illegal means.
People wey fit kidnap themselves and they request for bitcoin as payment, then dem sabi Wetin bitcoin Dey about, they know say no be get rich quick scheme e be, na just criminal dem be. Na just newbies wey never even enter crypto space fit Dey reason say bitcoin na get rich quick scheme.