Bitcoin Forum
May 28, 2024, 01:11:08 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: NERDMINER: Bitcoin lottery miners  (Read 61 times)
Hatchy (OP)
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 420
Merit: 480


The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID


View Profile
January 19, 2024, 08:24:15 PM
 #1

watin be dis tin?



Topics:


1.make una take note!!!

make sure say u read dis one well before u even start to dey read dis thread.
TAKE NOTE, VERY IMPORTANT
dis project no fit make u profit as d user. with dis kind setup, u no fit mine even one Satoshi for ur full life.dis one no be for economic gain. high chance dey say u fit loss all d money wey u put for dis project.


2.Watin be Nerdminer

na one Valerio Vaccaro, na him start dis project from e own idea of one man mining. na dis guy Valerio na e still start d "Satoshi Spritz", one way, for people wey dey into Bitcoin locally to tay meet up and e don cast well well now for more than 20 place for inside Italy.
for inside dis meet up, wey Dem dey normally dey run for place wey dey accept Bitcoin, Valerio con show Dem some kind gadget: Bitcoin nodes, LN nodes ad LN ATMS, but better device wey Dem tay dey mine, con dey miss. so he con get idea and start to dey code. e use some commodity programmable board Dem and con put Dem together tay form d first part of e mining device wey dey portable. e normally na übernerd, so e con name e device Hansolo Miner. d software b dey important with one kind graphical design wey get limited features.

Bitmaker con see dis project and with Dem own likeness for software con re-create am, rebrand am as Nerdminer and con add graphical interface wey dey friendly and new features Dem.

Nerdminer fit run for many boards dem, but d most common one na Lilygo S3;



dis ones na d boards wey go fit run 1.61.
  • -- LILYGO T-Display S3
  • -- ESP32-WROOM-32, ESP32-Devkit1..
  • -- LILYGO T-QT
  • -- LILYGO T-Display 1.14
  • -- LILYGO T-Display S3 AMOLED
  • -- LILYGO T-Dongle S3
  • -- ESP32-2432S028R 2,8"


d wan wey dem release last con dey support other boards and Dem go still design many.

d board dey eat less dan 2w of power, dat wan means say for a whole year, u fit on am for less dan 5EUR.
d wan wey Dem design last con carry d total powerhash go 55kh/s as highest value.
dis wan mean say d Nerdminer get efficiency ratio of 36,360 J/GHs. s19 XP Hydo fit work for 0.021J/HGS.. d Nerdminer dey work 1,500,000 times less pass d wey miner Tay dey work.

once e dey online, na dis pool nae d nerdminers dey connect to: https://web.public-pool.io/#/



plenty pools go reject d nerdminers or some devices wey still get low hash power becos of d low hash rate. public pool go fit accept even d smallest mining machine and no go collect fees. only miners above 50th/s na go dey d 1.5% mining pool.

abeg make u know say d 4500 nerdminers get hash power 10^-10 times of one single Antminer. dat wan mean say e go take around 2,750,000,000 S3 to make one single S19. imagine say you dey give every body wey dey dis planet 1 Nerdminer: dis one go total hash power of just three
S19.

remember say Bitcoin network currently dey powdered by 2.5 million equivalent of dis machine Dem. dis wan mean say one S19 go fit mine one block every 46 years.

if 2,500,000 S19 fit find one block every 10minutes approximately, one single S3 Nerdminer go take 125,570,776,256 years ( basically 10 times d age of d universe) to tay look for one block. dis one don supposed tell you say you no fit mine any block for your entire life wey you take set am up.

if you dey find further information for this matter, I go say make you read the following link

Bitcoin- Nerdminer and BitAxe dey profitable?

to add join am, I don do one excel spreadsheet:




3.Why e dey important
watin come be the need of all these stress, if better profit no dey? why i go loss money and time if d pool no go mine single block for your full life?
well, na two reason;

Learning
Bitcoin mining na business wey need plenty money and e dey very competitive. plenty people no wan take part for dis part of Bitcoin matter. with Nerdminer, you fit start mining with small start up money. dis wan go make you fit handle d important tins de wey mining dey about: run hardware, manage pool, dey with mining protocols, and many other tins Dem. d learning curve fit dey straight, but dis miner fit help you learn those tins wey for hard well well.
you go also learn tins about d basic of mining matter, how u go tay manage temperature, and handle firmwares etc.
for dis project learning something new na just be d main idea of d whole project.

Bitcoin canary for inside mine.
Bitcoin na technology wey dey open source and dey distributed. as long as every user fit run d network primary  function for open source and Dem fit buy am, d assumptions of d Bitcoin technology go dey valid.

table]
DIY setup we I do personally for basic Bitcoin Protocol Functions (credit card for refrerence)

now, you fit run full Bitcoin node with hundred dollar hardware, Bitcoin miner with 50 dollars and secure your private keys with diy hardware wallet for 15 dollars.
with your Bitcoin node, you go fit validate Blockchain and transactions. with mining node, you go fit add block join Blockchain. with hardware wallet, you fit sign new transaction securely. All dis with open source software and for some case na open source hardware.

normal, you no get all those extra tins wey commercial solutions get, or for case of mining hardware, you no get any real chance to follow fight for block. but d main thing be say you dey fit do d same calculations like professional miners. your small Nerdminer dey play for same level statistics as d correct miners Dem. na only d big money wey Dem put for dem own competition na give Dem more advantage,as d pow talk no be technical protocol advantage over your hardware.


4. How I Go Tay Get Nerdminer?

I talk am as Valerio Vaccaro's post Tay talk am here.
You get three options.
1DIYbuy all d piece for Ali, flash device and solve d problem wey dey. you go enjoy your self, learn something and save money.
2Official Nerdminer Websiteyou go need support d developers if d nerdminers, and help Dem tay improve dem work with new release, with increase and new things wey e fit do
3talk with other Bitcoin miners den and enjoy una self togethermeet other Bitcoiner for local meetings, buy dem nerdminers, make d local community last long and share knowledge.dis na how d virus Tay spread for Italy.
                                                                   

5. Nerdminer Setup
to set up d nerdminer dey very simple.
in fact sef, you get at least some method, the easy way or the hard way. na you con know, your time and your how you Tay good for d technical part to decide which one go go. me I go for the easy way and I go talk say e dey very simple.

Them describe d whole process for d nerdminers website:

Nerdminer Setup Guide

once I don get d easy way, na for me to come start to dey play with d software, to tay get some tricks.

basically, you go need to:

  • Connect d Nerminer to  USB port wey dey your PC
  • Connect go d website https://bitmaker-hub.github.io/diyflasher/ make you for flash your device
  • Click button to tay flash d nerdminer
  • Connect go your Nerdminer with Wi-FI (connect to NerdminerAP with your phone, just follow d instruction wey dey screen
  • Setup d Wi-Fi details, and Bitcoin address where you go dey deposit your satoshi (in case).
     

When your nerdminer don dey connected, you fit come  connect go d pool and monitor as say e dey work.
Just open browser make you go:
https://web.public-pool.io/#/app/YournerminerBitcoinaddress to tay monitor am.

for here, you fit monitor d mining stats of your nerdminers wey dey connected to d pool..


you still get some normal button to tay monitor d status of your nerdminer;
 



6. Community

Nerdminer na community wey dey grow.
everything dey around d telegram channel, where nice set of people wey like am don dey catch some fun ideas.



you dey invited to join dis crazy community.


7. Resources dem


https://bitronics.store/nerdminer/Official Nerdminer Website
https://twitter.com/BitMaker_Twitter Handle of Bitmaker, wey create d Nerdminers
https://t.me/teamNerdMinerOfficial Telegram Group
Micro $3 Bitcoin miners won't make bank,
but that's not the point — Inventors
BitMaker's interview for Cointelegraph.
In-depth explanation of Bitcoin Mining DifficultyA introduction to bitcoin difficulty. plenty tins wey Dem dey talk for mining dey well explained for dis page.
                                                                   


8.Other Project dem

Nerdminer no be d only open source mining project. other projects dey wey pass dat wan. some of Dem even dey try develop hardware wey dey open source.

Han Solo Miningwhere everything start from. Valerio Vaccaro still dey develop Hansolo miners Dem. he dey add support join new boards and dey improve d software wey don dey. All dis work for come last last enter d Nerdminer code.
BitAxeopen source software for open source hard ware wey resemble am. d smallest ever ASICs wey Dem make with single Antminer S17 chip. Mining 520 GH/s fr power consumption of 10W. see the  Telegram Group.



dis project also get thread for dis forum:
Open Source Bitcoin ASIC miner project wey dey use 2x BM1387 (Antminer S9)
Cpuminer-android Android application wrapper for Pooler's CPUMiner. Ubiquotous mining for your old android phone


TAKE NOTE, VERY VERY IMPORTANT
dis project no fit make u profit as d user. with dis kind setup, u no fit mine even one Satoshi for ur full life.dis one no be for economic gain. high chance dey say u fit loss all d money wey u put for dis project.


ORIGINAL POST: NERDMINER: Bitcoin lottery miners
AUTHOR: fillippone


na AOBT na run dis Translation by Dem self

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBIT|
4,000+ GAMES
███████████████████
██████████▀▄▀▀▀████
████████▀▄▀██░░░███
██████▀▄███▄▀█▄▄▄██
███▀▀▀▀▀▀█▀▀▀▀▀▀███
██░░░░░░░░█░░░░░░██
██▄░░░░░░░█░░░░░▄██
███▄░░░░▄█▄▄▄▄▄████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
█████████
▀████████
░░▀██████
░░░░▀████
░░░░░░███
▄░░░░░███
▀█▄▄▄████
░░▀▀█████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀
█████████
░░░▀▀████
██▄▄▀░███
█░░█▄░░██
░████▀▀██
█░░█▀░░██
██▀▀▄░███
░░░▄▄████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀
|
██░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░██
▀█▄░▄▄░░░░░░░░░░░░▄▄░▄█▀
▄▄███░░░░░░░░░░░░░░███▄▄
▀░▀▄▀▄░░░░░▄▄░░░░░▄▀▄▀░▀
▄▄▄▄▄▀▀▄▄▀▀▄▄▄▄▄
█░▄▄▄██████▄▄▄░█
█░▀▀████████▀▀░█
█░█▀▄▄▄▄▄▄▄▄██░█
█░█▀████████░█
█░█░██████░█
▀▄▀▄███▀▄▀
▄▀▄
▀▄▄▄▄▀▄▀▄
██▀░░░░░░░░▀██
||.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
░▀▄░▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄░▄▀
███▀▄▀█████████████████▀▄▀
█████▀▄░▄▄▄▄▄███░▄▄▄▄▄▄▀
███████▀▄▀██████░█▄▄▄▄▄▄▄▄
█████████▀▄▄░███▄▄▄▄▄▄░▄▀
███████████░███████▀▄▀
███████████░██▀▄▄▄▄▀
███████████░▀▄▀
████████████▄▀
███████████
▄▄███████▄▄
▄████▀▀▀▀▀▀▀████▄
▄███▀▄▄███████▄▄▀███▄
▄██▀▄█▀▀▀█████▀▀▀█▄▀██▄
▄██▄██████▀████░███▄██▄
███░████████▀██░████░███
███░████░█▄████▀░████░███
███░████░███▄████████░███
▀██▄▀███░█████▄█████▀▄██▀
▀██▄▀█▄▄▄██████▄██▀▄██▀
▀███▄▀▀███████▀▀▄███▀
▀████▄▄▄▄▄▄▄████▀
▀▀███████▀▀
OFFICIAL PARTNERSHIP
FAZE CLAN
SSC NAPOLI
|
Hatchy (OP)
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 420
Merit: 480


The Alliance Of Bitcointalk Translators - ENG>PID


View Profile
January 19, 2024, 08:33:29 PM
 #2

Well, my country people. I don bring this obonge Tori wey I find for forum by fillippone. This na one of d most surprising Innovation wey I don see so far when it comes to mining matter. With dis Nerdminer, you fit turn miner with just little money. Yes, the mining no dey profitable at all and as @ fillippone Tay talk am, you fit no mine anything for your life. Now watin be the use of this miner if e no dey profitable. The whole process just dey to give you dis feeling of a miner. Well, make una try read dis one as na correct gist na e carry come for una.
 

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBIT|
4,000+ GAMES
███████████████████
██████████▀▄▀▀▀████
████████▀▄▀██░░░███
██████▀▄███▄▀█▄▄▄██
███▀▀▀▀▀▀█▀▀▀▀▀▀███
██░░░░░░░░█░░░░░░██
██▄░░░░░░░█░░░░░▄██
███▄░░░░▄█▄▄▄▄▄████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
█████████
▀████████
░░▀██████
░░░░▀████
░░░░░░███
▄░░░░░███
▀█▄▄▄████
░░▀▀█████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀
█████████
░░░▀▀████
██▄▄▀░███
█░░█▄░░██
░████▀▀██
█░░█▀░░██
██▀▀▄░███
░░░▄▄████
▀▀▀▀▀▀▀▀▀
|
██░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░░██
▀█▄░▄▄░░░░░░░░░░░░▄▄░▄█▀
▄▄███░░░░░░░░░░░░░░███▄▄
▀░▀▄▀▄░░░░░▄▄░░░░░▄▀▄▀░▀
▄▄▄▄▄▀▀▄▄▀▀▄▄▄▄▄
█░▄▄▄██████▄▄▄░█
█░▀▀████████▀▀░█
█░█▀▄▄▄▄▄▄▄▄██░█
█░█▀████████░█
█░█░██████░█
▀▄▀▄███▀▄▀
▄▀▄
▀▄▄▄▄▀▄▀▄
██▀░░░░░░░░▀██
||.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
░▀▄░▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄░▄▀
███▀▄▀█████████████████▀▄▀
█████▀▄░▄▄▄▄▄███░▄▄▄▄▄▄▀
███████▀▄▀██████░█▄▄▄▄▄▄▄▄
█████████▀▄▄░███▄▄▄▄▄▄░▄▀
███████████░███████▀▄▀
███████████░██▀▄▄▄▄▀
███████████░▀▄▀
████████████▄▀
███████████
▄▄███████▄▄
▄████▀▀▀▀▀▀▀████▄
▄███▀▄▄███████▄▄▀███▄
▄██▀▄█▀▀▀█████▀▀▀█▄▀██▄
▄██▄██████▀████░███▄██▄
███░████████▀██░████░███
███░████░█▄████▀░████░███
███░████░███▄████████░███
▀██▄▀███░█████▄█████▀▄██▀
▀██▄▀█▄▄▄██████▄██▀▄██▀
▀███▄▀▀███████▀▀▄███▀
▀████▄▄▄▄▄▄▄████▀
▀▀███████▀▀
OFFICIAL PARTNERSHIP
FAZE CLAN
SSC NAPOLI
|
letteredhub
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 532
Merit: 204

My privacy, my right.


View Profile
January 19, 2024, 10:24:12 PM
 #3

Well, my country people. I don bring this obonge Tori wey I find for forum by fillippone. This na one of d most surprising Innovation wey I don see so far when it comes to mining matter. With dis Nerdminer, you fit turn miner with just little money. Yes, the mining no dey profitable at all and as @ fillippone Tay talk am, you fit no mine anything for your life. Now watin be the use of this miner if e no dey profitable. The whole process just dey to give you dis feeling of a miner. Well, make una try read dis one as na correct gist na e carry come for una.
 
You don do well by bringing to us this informate, but you know how we country be nah with all the Sapa levels nobody go wan spend time, energy and money the run this matter say the aim at last na to just get that feeling of  a miner. Inno make sense from this corner, if na the knowledge no problem but to say na for sake of  just a feeling then na fvck up. My own be say I don catch one or two ideas from this thread as you interpret am for we local pidgin and na just that one the sweet. Anything no the the bring money as profit no be something to try am at all.... Country hard.
Samlucky O
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 294
Merit: 252


The great city of God 🔥


View Profile WWW
January 20, 2024, 04:28:48 AM
 #4

Omoh  you can translate for Africa. Emagin dis luxurious translation.. hmm me no get this time to read this post for now o. But anyway for this matter wey you dey yan, wetting be the de need to use mining machine wey no dey mine real Bitcoin? Just like  demo mining. That one na just to decive people say person get mining tool wey no fit even mine anything forever. Wetting me I fit concluded for the hole matter na say make people dey careful make dem no go buy mining machine wey no fit min anything. Just like one charger wey I buy, instead of am to add bar to my phone na remove E dey remove the one wey dey.

███████████████████████████████▀▀▀▀
███████████████████████████████
█████████▀▀▀▀▀█▀█▀▀▀▀▀█████████
███▄▀▀▀   ▄▄▄▄   ▄▄▄▄   ▀▀▀▄███
███████▀▀▀████▌ ▐████▀▀▀███████
█████▀███▀█▀██▌ ▐██▀█▀███▀█████
███████▀▄▀▄███▌ ▐███▄▀▄▀███████
█████▄██▄██▄██   ██▄██▄██▄█████
███████▄▄▄████   ████▄▄▄███████
██████████▀▀▀▀   ▀▀▀▀██████████
██████████▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄██████████
███████████████████████████████
███████████████████████████████▄▄▄▄
▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀
.
TRUST DICE
.
▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
█▀▀▀











█▄▄▄
#1 RATED CRYPTO
CASINO IN THE WORLD
██ ██ ██ ██ █Trustpilot
▀▀▀█











▄▄▄█
▄█████████████████████████████
██████████████████▀▀█████▀▀████
█████████████████▀█████████▀███
██████████████████████████████
███████████████████████████▄███
█████████████████████████▄▄████
███████████████████████████████
█████████████░░░███████████████
███████████░░░█████████████████
█████████░░████████████████████
█████░░░██████████████████████
███░░█████████████████████████
▀░░░█████████████████████████▀
█▀▀▀











█▄▄▄
▀▀▀█











▄▄▄█
Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!