To be youth for this country no easy at all, the way our country done dey now, e Dan give us the youths the impression say government no get our interest at Heart, with the way Nigeria youths dey creative and hard working, even in the face of this hardship and unemployment most youths still find way to improve themselves, through other means like crypto currency, social media etc,
So this our mentality is second to non in Africa, the way Nigerians dey hustle if we get better economic atmosphere for this country more youths go make in the face of all the hardships and pressure.
No be small thing o, youth just dey suffer anyhow for this hardship and pressure wey full everywhere, even person wey dey work dey like say e no dey work because of the spending wey e dey do, no be say we dey spend am carelessly but because of our things dey cause and our salary no dey do again, so because of all this pressure and how the hardship still dey increase, some don dey enter illegal activities dem wey go fetch dem quick money to sort out things for themselves such as emergency and all that, if no e no easy to survive for this country as a youth o, even people wey no be youth still dey suffer, na e mk at times i no dey blame our youths wey join yahoo because no be really their fault if we check am well, some of them join because of pressure maybe to eat o or to pay bills etc but na e mk to create awareness dey good, better one o like this Bitcointalk wey no dey illegal to join, meanwhile no be everybody dey like to pass through sweat just dey make money, but anyhow this country won turn upside down, we go still survive.