Omor d issue of fraud aka street or Yahoo now don dey sound like pandemic for dis our society, before e dey be like say no be serious tin based on say dem never dey do ammcom local but d sad tin be say now wdem dey do am everywhere both home and abroad, dem dey wan collect from everybody, most of dem sef if u call dem now say make dem come work dem go say no because dem believe say u no fit pay dem based on d kain money wey dem don see for d yahoo business so even at some point I no go even say na lack of job dey cause am, na just mind set and d fact say pipo no get patience again, dem wan just make am for life even without working sef, dem wan get soft life wey dem no hustle for early and na dat dey be dia biggest problem wey dem never try understand well, I dey hope say a change of mentality go happen for dis we country one day because d kain time dem dey dedicate to doing dia tinz, if dem put am learn skill, dem go do better in less Dan no time but dem no wan gree.
The act of fraud for we society now don pass that of the excuse of say na lack of jobs the cause am. I mean some of these young guys just like the fraudulent activity and take pride in it say than for them to work for person make them rather the run street. And worse of it all be say parental failure follow get role of this matter. Back days if pikin get one kind big money the parents go question am to know the source but today parents no even the bother about the source , their own be say God don bless their pikin. And this is very bad for the new generation who don com see scam as a means of survival and nothing of a crime.