Bitcoin Forum
July 10, 2024, 07:59:06 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: « 1 2 3 4 [5]  All
  Print  
Author Topic: Why some newbies dey quick lose interest for the forum??  (Read 834 times)
Awwal08
Member
**
Offline Offline

Activity: 854
Merit: 13

Axioma Holding - Axioma Pay Crypto Card


View Profile
July 07, 2024, 08:28:08 PM
 #81

Na becos say dey no meet di forum di way dem think say him be, di reason y some of dem joined di forum na him bi becos dem dey hear people talk say dem dey make a lot of money on di forum, after dey con join, dey come find out say he no easy to be a member of di forum, some of dem no wan see demselves as a newbie, dem dey eager to become a member, wen dey con see dat dey get long way to go, dey give up easily, some wan make di money willingly, na dat be di reason y dey no go study the rules and regulation wey dey guide di forum,  dey no even bother denselves to know what bitcoin is,  some people wey dey as a member today, dem  dey very long for newbie nd also face a lot of challenges, but becos dey exercise patient, dey reached where dem dey 2day.

Nheer
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 518
Merit: 507



View Profile WWW
July 07, 2024, 10:12:34 PM
 #82

I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
Most of dem no really get orientation before dem join the forum, Dem dey reason say if you just enter and you post, then merit go Dey enter be that, and dem go rank up, but if dem post finish, and dem see say people blast their post which is normal on the forum here, they will be disappointed and most of them go give up, some go talk say dem no fit do am. But Wetin I go tell most people be say, no matter how dem talk bad about your post, e no mean say make d person give up, just ready everything wey everybody post, and make you try correct yourself, gradually you go improve.
Na just the thing be that, had it been dem get better orientation things for no end like that for them. This forum no de tolerate mistake and nobody care wether you be newbie or wether na your first post for the forum, dem believe say everybody suppose get sense say as them enter new place dem go first learn about the place before dem engage in anything na why dem no de tolerate mistake be dat and most newbies are not mentally prepared them no really de interested to learn dem just de find how dem go get merit make dem rank up and when dem criticize them they get discouraged easily.

Wetin dem no understand be say na knowledge dem need first but since dem no get orientation dem just think say na so things de easy for here, i believe say dem no ready na why dem de give up easily, nothing is ever easy in this life so you just have to be strong and dedicated if you really want to be successful.

R


▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄
████████████████
▀▀▀▀█████▀▀▀█████
████████▌███▐████
▄▄▄▄█████▄▄▄█████
████████████████
▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀
LLBIT
  CRYPTO   
FUTURES
 1,000x 
LEVERAGE
COMPETITIVE
    FEES    
 INSTANT 
EXECUTION
.
   TRADE NOW   
Derek jnr2001
Newbie
*
Offline Offline

Activity: 28
Merit: 3


View Profile
July 08, 2024, 06:54:26 AM
 #83

My brothers and sisters for this kajad cabal I greet una and happy new year to all of us. I say make I table this matter for here and if say person don discuss this mata, my apologies as I no see any of such nature before I bring this one up.
 Wetin make me dey ask this question nah say after observation, I discover how some newbies wey register here, after them don drop some posts and e happen say one of the posts receive backlash, you go see say gradually, that user go start to dey scarce for here  and before you know e go twy before you see them.
 So I wan know from us, wetin we feel say be the reason wey dem dey lose interest like that? Abi nah say some no fit stand criticism or here too hard or wetin? Abeg make we discuss.

I think the reason why most newbie they easily lose interest in this forum na because of say e no they work to their expectations, more especially when they talk about their post say in lack too many information them go come see am say people they indirectly tell dem say Dem no know waiting Dem dey do, way be say na correction Dem they give Dem. secondly the reason why most newbie they quick tire for this platform sometime na due to lack of patient some newbie when Dem don make too many post and e come happen say no single merit way them give them, at this point Dem go begin they lose interest Dem they always forget say merit they come depending on how quality your post is.

most newbie think say things they very easy for here those high ranked members Dem been dey the same shoe with us but due to how patient they're see where them dey today, so as a newbie make we try to learn how to exercise patient if any body talk about our post  make we no see am say the person hate us just see am say the person wan correct us so that we go fit improve.
Uhochi
Newbie
*
Offline Offline

Activity: 23
Merit: 2


View Profile
July 09, 2024, 07:41:14 AM
 #84

I'm glad I found this discussion topic because personally "I dey hurt".

I took 5 days off from this platform because of this issue.

My posts are being deleted, locked and my account reported for AI content and I know what I wrote.

 I'm not going to deny not editing and improving my content grammar and spelling errors with Grammarly or other tools that correct sentences.

But every idea was mine and a greater part of the words mine, just some suggestions from the tools.

Abi is it that I'm speaking too much English in the post, it now looks like AI? Abi I should purposely make mistakes in the post?

The painful part is when I check who reported my account it will be a legendary member.

The most painful is Nigerian legendary member and I'm like ah ah Nigerians why are we against each other even in public internet space.

 With all these your merits and activities you have what do you want from a newbie account like mine naw.

Abi are legendaries against newbie growth?
But then I shake that thought off because I've gotten 2 merits from legendary members and I felt so happy when I got it, which means not all legendaries are after my life.

The last one that broke me down was when I told myself ok maybe this my post they are reporting as AI content is because I allow inclusion from these tools, let me make it 100 percent organic, every word, every punctuation mine doings.

That was how I brought up a familiar topic from my head, "Bitcoin Impact on the Nigerian Economy".

Everything I wrote are things you and I are familiar with, the next thing I saw was the content was locked and the comment was "stop using AI to write. Last warning" .

No, that one pained me because I was already getting demoralized before now and this one again. Ah ah

I sent my rough draft and a message to the moderator that locked my content and commented, explaining that it is not AI written with evidence but till today the person has not replied.

I know say normally to survive in the world you must be though that is why I took a break and I'm coming back small small hoping that my content will not be deleted or reported. 


P:S I am an SEO writer, one thing I know is that AI tools can say an organic content is AI-written, it has been an issue in the content writing world for a while now.

So moderators and legendary members you all should please help newbies grow, it can be heartbreaking in this space 🤲.  Thank you
Pages: « 1 2 3 4 [5]  All
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!