The bitcoin market bottom price dipped to $101,000 yesterday way be over 21% drawdown from the $126,000 Ath. Puting to considerations based on speculations say political and economy news get influence to manipulate bitcoin price, una no think say the news of Donald Trumps to invade our country to sanitize insecurities via the religious genocide, una no think am say onto say our country face show for global crypto adoption say this news follow for wetin dey drive this market decline?
Bitcoin price no dey stable again since Trump just impose the task wey him impose on china, since that time na him bitcoin price no stable again. Trump don warn naija already, him talk say dem go invade us, Wetin I know be say Wetin dey happen currently na insecurity, and nothing like Christian genocide in dis country, Wetin dey na insecurity because people wey dey die no be only Christian’s alone, even Muslim’s are affected.
But I go talk say no be trump way wan invade naija cause d dump, I feel say news like dis no fit dump bitcoin price, if na all dis big country’s now e fit happen, but no be wetin dump bitcoin price be that.