Jessie2121 (OP)
Member

Offline
Activity: 335
Merit: 58
|
 |
October 28, 2025, 10:59:48 PM |
|
 Abeg my people this matter wey I see for Facebook I say make I bring am come here because I no understand wetin dey happen for this our churches and pastors them and up till now I still find am hard to sabi who be the better pastor wey God call or flash, wetin be this yeye things we dey see like this? Make we put mouth for this issue abeg because we know say many of us dey use Opay so make we know how we dey drop cash for their that's if this talk na true because me I no like this Opay and the rest of them even all these pastors with prophesy we don see them well well and hear their talk finish. This one na something wey we go believe or not?
|
|
|
|
|
Oshio-man
Full Member
 
Offline
Activity: 518
Merit: 129
Be patient with your future.
|
 |
October 29, 2025, 03:48:55 AM |
|
Even though opay bank is going to fold up in the month of December, it will not be this year because they have solid foundation that will make the opay bank to continue working well to serve her customers nationwide, we have hear many fakes prophecy from fake pastors in our country, which nor of the prophecy come to pass, if you are using opay to store your money or make any transactions in the country, don't be panic with this kind of news because government will not allow it to happen because the company have registered the opay bank.
|
|
|
|
Jubilee58
Member

Offline
Activity: 84
Merit: 13
|
 |
October 29, 2025, 09:01:22 AM |
|
Personally, I know that opay is not a fake financial technology platform as they are fully registered with the Nigeria deposit insurance corporation (NDIC), and one among the most recognized tech. platforms and is being used by large number of Nigerians for savings and business transactions.
Banks use to liquidate as a result of financial mismanagement, and is possible that opay can also liquidate one day , that is if there is financial mismanagement, though am not saying it is going to liquidate.
There are processes one has to undergoe before being able to open a financial tech company, because it is something that involves money, more especially banks , there is a huge amount of money that you are expected to deposit with Nigeria deposit insurance corporation before you can operate as a bank , should in case there is a liquidation, so that the customers can get back their money.
So i believe, even if opay happens to liquidate, because they are registered and licensed by Nigeria deposit insurance corporation, customers can always recover their money.
|
|
|
|
|
Jessie2121 (OP)
Member

Offline
Activity: 335
Merit: 58
|
 |
October 29, 2025, 02:47:54 PM |
|
E get wetin we need to know, I don already accept say Opay na legit people them be but my problem na this pastors them wey dey talk things to confuse the public and put them for high fear fear level which I see as something wey no good, why them no channel this prophesy energy to this our country and why them no dey talk about how this our suffer for this country go stop? Abi their God no dey tell them that one? See eh this pastor business don enter another level now to the point wey government suppose close down some churches for this country, the fake noise them dey make too much after them go say na our heavenly father tell them, them dey mislead plenty people honestly. If one go talk how the country go better and what year e go better but this pastors focus more on things wey no matter because na where the public eyes dey nai make, now na Opay to shut down, na wa oh.
|
|
|
|
|
|
Majestic-milf
|
 |
October 30, 2025, 12:33:08 PM |
|
Sometimes, people go just carry predictions full mouth come dey mistake am as message from God. (I know say people go wan fire me for this statement)  , but if we dey honest, we go know say some of these men of God go dey claim and proclaim things wey go just push them into limelight and e dey clear say no be divine ministration. So wetin happen if Opay close down? No be bank at the end of the day? So nah this one be the problem the country dey face now or nah just say him wan start from somewhere dey boost him popularity. Despite the fact say Opay get more trust than the normal traditional banks, e still no be assurance say e no fit get issues so if this prophet dey see road, why him no fit talk when 1 dollar go be equal to 1 naira.
|
|
|
|
|
SmartCharpa
|
 |
October 30, 2025, 02:59:30 PM |
|
Abeg my people this matter wey I see for Facebook I say make I bring am come here because I no understand wetin dey happen for this our churches and pastors them and up till now I still find am hard to sabi who be the better pastor wey God call or flash, wetin be this yeye things we dey see like this? Make we put mouth for this issue abeg because we know say many of us dey use Opay so make we know how we dey drop cash for their that's if this talk na true because me I no like this Opay and the rest of them even all these pastors with prophesy we don see them well well and hear their talk finish. This one na something wey we go believe or not?
If you no like OPay or any of these online banks, na you sabi. No be today dem start to dey operate for this country. Sometimes we dey do like say we no know say the world dey change every single day. Maybe that man of God still dey live for the world of yesterday, when person go queue tire before e fit see money collect from bank. See all this na too much talking. E fit be say the man God just wan trend small make people dey look am. How person go dey see wetin go happen to OPay for 2026 but e no fit see how this our country go be next year? Whether e go better or e go worse, that one no enter vision? Make we dey reason am well. Na we sabi how OPay don help us for this country wey cash problem no dey ever finish. Sometimes when this banks they have network issues, everybody switches to OPay. So anybody wey wan just open mouth talk say OPay go close, make dem bring better evidence abeg. No be every prophecy why no get direction go put fear for our body.
|
|
|
|
|
|
| R |
▀▀▀▀▀▀▀██████▄▄ ████████████████ ▀▀▀▀█████▀▀▀█████ ████████▌███▐████ ▄▄▄▄█████▄▄▄█████ ████████████████ ▄▄▄▄▄▄▄██████▀▀ | LLBIT | | | 4,000+ GAMES███████████████████ ██████████▀▄▀▀▀████ ████████▀▄▀██░░░███ ██████▀▄███▄▀█▄▄▄██ ███▀▀▀▀▀▀█▀▀▀▀▀▀███ ██░░░░░░░░█░░░░░░██ ██▄░░░░░░░█░░░░░▄██ ███▄░░░░▄█▄▄▄▄▄████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ | █████████ ▀████████ ░░▀██████ ░░░░▀████ ░░░░░░███ ▄░░░░░███ ▀█▄▄▄████ ░░▀▀█████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀ | █████████ ░░░▀▀████ ██▄▄▀░███ █░░█▄░░██ ░████▀▀██ █░░█▀░░██ ██▀▀▄░███ ░░░▄▄████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀ |
| | | | | | | | | ▄▄████▄▄ ▀█▀▄▀▀▄▀█▀ ▄▄░░▄█░██░█▄░░▄▄ ▄▄█░▄▀█░▀█▄▄█▀░█▀▄░█▄▄ ▀▄█░███▄█▄▄█▄███░█▄▀ ▀▀█░░░▄▄▄▄░░░█▀▀ █░░██████░░█ █░░░░▀▀░░░░█ █▀▄▀▄▀▄▀▄▀▄█ ▄░█████▀▀█████░▄ ▄███████░██░███████▄ ▀▀██████▄▄██████▀▀ ▀▀████████▀▀ | . ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ░▀▄░▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄░▄▀ ███▀▄▀█████████████████▀▄▀ █████▀▄░▄▄▄▄▄███░▄▄▄▄▄▄▀ ███████▀▄▀██████░█▄▄▄▄▄▄▄▄ █████████▀▄▄░███▄▄▄▄▄▄░▄▀ ████████████░███████▀▄▀ ████████████░██▀▄▄▄▄▀ ████████████░▀▄▀ ████████████▄▀ ███████████▀ | ▄▄███████▄▄ ▄████▀▀▀▀▀▀▀████▄ ▄███▀▄▄███████▄▄▀███▄ ▄██▀▄█▀▀▀█████▀▀▀█▄▀██▄ ▄██▀▄███░░░▀████░███▄▀██▄ ███░████░░░░░▀██░████░███ ███░████░█▄░░░░▀░████░███ ███░████░███▄░░░░████░███ ▀██▄▀███░█████▄░░███▀▄██▀ ▀██▄▀█▄▄▄██████▄██▀▄██▀ ▀███▄▀▀███████▀▀▄███▀ ▀████▄▄▄▄▄▄▄████▀ ▀▀███████▀▀ | | OFFICIAL PARTNERSHIP SOUTHAMPTON FC FAZE CLAN SSC NAPOLI |
|
|
|
TrialBitcoin
Newbie
Offline
Activity: 42
Merit: 0
|
 |
October 31, 2025, 08:21:39 PM |
|
https://i.ibb.co/Rk3MXBtg/IMG-20251028-234437.jpgAbeg my people this matter wey I see for Facebook I say make I bring am come here because I no understand wetin dey happen for this our churches and pastors them and up till now I still find am hard to sabi who be the better pastor wey God call or flash, wetin be this yeye things we dey see like this? Make we put mouth for this issue abeg because we know say many of us dey use Opay so make we know how we dey drop cash for their that's if this talk na true because me I no like this Opay and the rest of them even all these pastors with prophesy we don see them well well and hear their talk finish. This one na something wey we go believe or not? All this Nigerian fake pastors, all this years of service Opay didn't close, it's now they have built strong customer service and everyone is now relying on them that they will Carter away with people's hard earned money. I pity those that believe all this pastors. Nigerian pastors and fake prophecy are 5&6. Do you know most pastors staged their miracles and wonders?, here is what they do, they go to a different state and negotiate with people, pay them and ask them to pretend as if they are disabled and when they start praying if it's wheelchair they want to use for the staging, as the pastor is praying the he will quickly stand from the wheelchair as someone God has healed, there are still decent and clean pastors whose prophecies comes to pass but the number of fakes amongst them is many.
|
|
|
|
|
|
|
|
Majestic-milf
|
 |
November 02, 2025, 02:25:47 AM |
|
The man no apologize like say wetin him talk nah lie. Him only say him dey sorry if the prophecy upset the Fintech company but him go still talk the message wey God give am so personally, no be like him dey fear, him just dey talk as e dey am. All I know be say these so-called prophets and seers only dey after popularity and name, things wey dey materialistic. Sha, make I no talk too much. The matter go only dey revealed with time.
|
|
|
|
Jessie2121 (OP)
Member

Offline
Activity: 335
Merit: 58
|
 |
November 02, 2025, 07:13:07 AM |
|
Chai God, I say if them never do one of these fake lie lie pastors something the others no go ever learn, oya na imagine the talk, him apologize say wetin him talk no suppose come out or him wan do as people go recognize am pass as before? Nai make some persons no like to go church becos the amount of jokers churches dey get as pastors all in the name of prophecy and all that dey annoying to even think of to join one church. People dey use church as business not as a place to win souls for God, them deyore focused on the money and to trend like say na so Jesus do when him dey for earth, religion dey kill us for Africa honestly, white man carry am give us take our sense.
|
|
|
|
|
PhilosopherKing
Newbie
Offline
Activity: 28
Merit: 4
|
 |
November 02, 2025, 10:39:07 AM |
|
No be everything wey you see for online wey we suppose to be believing. This is simply rumour, e sure me sef say even that pastor wey dey prophesy sef dey use opay. Mtcheew.
|
|
|
|
|
Jessie2121 (OP)
Member

Offline
Activity: 335
Merit: 58
|
 |
November 02, 2025, 11:37:09 PM |
|
No be everything wey you see for online wey we suppose to be believing. This is simply rumour, e sure me sef say even that pastor wey dey prophesy sef dey use opay. Mtcheew.
Wetin you talk na true infact all wetin you talk na true but make we take this particular one as eye opener to know when to say this one na true or false. The pastor don talk make e be say nah him name or face show for media so people go begin expect the prophecy to happen and again this social media space dey really spoil things I no go lie, if na before which pastor get time to come out for the media to say see wetin him see from God or wetin God tell am, the pastors know say now na the time wey youths dey showcase their doings and the only place wey them full na social media nai make them need to come the media to follow attract attention since to go the church these days na hard thing and they really need members to full the church so make them use every means to get members, na where we find ourselves like this.
|
|
|
|
|
VivaMan
Newbie
Offline
Activity: 28
Merit: 0
|
 |
November 07, 2025, 10:16:44 AM |
|
Sometimes no be all prophecy be prohecy oo some people and pastors do this just to get famous, popular and well known to everyone. Some people do or say something crazy 🤣 just case clown and drag followers in the media. Most of them do this for fun 😊 and keeping their account growing with likes, comments and monetize of account. Opay is a well legal banking system authorize licence by the Central Bank of Nigeria . Giving out good transaction system which one can send and receive money around the world 🌎 giving access to loans and saving insurance advancing financial accessibility and accountability.
|
|
|
|
|
|
Majestic-milf
|
 |
November 07, 2025, 01:54:18 PM |
|
No be everything wey you see for online wey we suppose to be believing. This is simply rumour, e sure me sef say even that pastor wey dey prophesy sef dey use opay. Mtcheew.
I no go lie give you, this your response crack me up because nah beta point you make and despite say e short, nah the summary you just drop be this. Most times, the things wey we dey see for social media no be all wey truth dey am and even though some of them fit be true, the matter no go really require us to lose sleep and e come be say nah pastor wey dey pass the information, e dey necessary to no completely believe am cause plenty fakes dey wey wan blow their ministry on the back of someone else efforts.
|
|
|
|
|