How u want take know self say person take highest risk? Well make I reason am say highest risk depends on bear ability and tolerance level else, I no think say e get wetin be highest risk for bitcoin bcos, where ur risk tolerance no fit carry na even a start point for some others.
Wetin just dey there be say investing for bitcoin dey very risky and so e dey very wrong for anyone to go take loans all to trade because, trading on em own dey risky and unpredictable. Maybe we fit just com look am this other way to say loaning to trading on bitcoin na the highest risk but I disagree say na em dey give the highest rewards.
Na true talk wey you talk like this but if you know wetin you dey do, that is understand how Bitcoin works and be prepared for everything fit grant you the chance of getting rewards but whereby, person no even get any idea of how things dey go, you no even ask questions for guidance or make research and you just enter, boom! you start to dey trade or invest. One thing dey clear say as person rush enter, Na so them go rush come out to come face the consequences of your actions.
Na E be why, anything wey involved crypto, person gats to dey very careful and be mindful of their actions or activities.