I think this matta don do for us because we country no be wetin we go put too much eyes than focusing and cleaning away anything politics from this group because if you check this out board out of 50 to 60 percent topics are basically on election and government matter so I suggest we should leave them to be at this moment. Just as @Igebotz already said.
lol,,,the reason why we finam hard to forget be say politics belongs to everybody,and we dey talkam base on say na sometin wey concern everybody,,,if we no talk something aboutam,,then e neva complete.them dey Callam government of the people,for the people,and by the people,that is to say na still we go make the government,without us,e no go fit function.Our people dey say" wetin dey person teeth,the tongue no dey gree leavam.Government na wetin we no go fit leave to talk aboutam no matter how we try,because them go definitely still do something wey go either hurt us or please us. It is upto us to either choose to talk good about,or to talk bad about we government.