The reason why loan apps been they use call finish people na because so many people go collect loans and would refuse to pay, these loan apps agents go call them tire, send them messages and they still no go gree pay, me i no like the idea of calling friends, family and relatives of the person wey take loan, because them been no they there when you give the person loan, they were never guarantors or sureties to the loan, so why you go they disturb them with calls. My main problem na with people wey no they gree pay back their loan, these loan defaulters are the real menace.
The harassment by this loan companies no be here, dem fit call reach your relatives wey dun die self but the main issue na say wen you dey register for this loans, dem no tell you say dem go call your relative oh if you no fit pay on time and besides this is invasion of privacy and na until this loan apps begin they exposed wetin apps wey dey your phone get access to people no for know say third party apps fit see your message, contacts etc. Dem dey hear but no dey believe until palmpay start to disgrace people.
Oyah the matter too dun enter google hand and dem dun drop update for the issue of loan apps having access to our contacts. Make una see as dem talk am below;
All this na welcome development and e mean say the government dey hear Nigeria people complains. E get plenty people this loan apps dun fall their hands and some no be say dem no wan pay back but one or twos go dun come up wey delay the payment but dat one no be excuse sha to pay people wey dey owe you.