My people, the day wey I notice say this forum pass bounty matter , that day I just dey curious to know more about other boards, na so I just see 'new post' under one particular board like that. Na so hit the button , e carry me go where I go write. Hmmm. I begin write ooo, later I con post am.
After I post am, body they shark me . After small time people they throw away reply give me, body con dey shark me more, the sharking make me reason am say, I dey see people they reply others for their post. So I decide to hit the quote button , boom na ihm be that.
As I know how to reply people, I start to deu reply every single person wey reply for my post.
Make I no lie you, people wey de do bounty get reason for doing that even though we know say the bounty no de pay like before as much project no de legit as before, but I know say one day dem go cash out too.
Abegy we no give newbies hope sae some day dem go cash out for the bounty wey dem d do. Make we dey plain with them by telling them the truth sae nothing d for bounty. The time wey bounty pay don go, I no believe sae such time go ever come again. Even if em go come, the number of people wey participate for am, no go be here. That will somehow reduce the pay wey each peso go get.
All the bounties wey I don do, which one wey don pay me big? Almost all of them no worth a dollar. Even the ones wey promise sae them go worth something in the future never list for exchange sef. Na promise upon promises wey dem d do more than a year now.
But this forum is actually pass bounty by far because if you de do bounty, you no go know anything we de happen for other sections of the forum, and there some good information about Bitcoin in the other sections.
Na the thing. The forum big pass bounty. If you only focus on bounty you go lack knowledge for crypto and how you go take grow for the forum to be a quality poster. Na wetin bounty d cause for peso side.
OP I no go advice you to keep on with altcoin bounty because na complete waste of time. Am telling you from experience. I no go like make person wey I wan better for to indulge in am at all.