I know say some people get different kind of investment goals, so some people go only sell once their investment goal is met, some people na condition or emergencies dy force their hands to sell, while some people prefer to dy take only the profit on top, some dy sell only during the bull season and some people don even vow say Dem no go touch their holdings till 5-10 years time regardless of wether the investment go dy profitable or not, so in essence of all this is please, when is the best time to sell? I know say most snr men for here go dy reason am say i surpose know this thing, but as e be so, I no just know the best time to sell, I don list out most of the scenario wey fit make person sell, but I no know which one be the best, abeg make ona enlightened me abeg.
Yiu don don already use your hand make the your question easier for an answer because, for this bitcoin investment as I dey usually talk am, time to take profit dey subjective depending on the investor's social-economic circumstance at hand.
Like you talk am, situation go fit make person take profit prematurely, some other people na fear or impatient. But certainly, time to take profit na for bulk run when the bitcoin price don the go to a new ATH, and as it don the go to a new ATH nah you go decide when be your own ATH to withdraw and not for you to wait for the market ATH. The truth be say no just dey greedy for excess profit.