Bitcoin Forum
June 15, 2024, 12:21:31 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: « 1 [2]  All
  Print  
Author Topic: Access bank hack: 500 USDT traders on Binance exchange bank accounts frozen  (Read 214 times)
Pi-network314159
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 252
Merit: 180


View Profile
October 30, 2023, 09:54:24 PM
 #21

BITTER TRUTHS
Now, wetin happen come dey make me see how:
1. non proactive our banking sector dey because e take Access bank 8days to freeze an account, which for me take too much time as e give the hacker enough time to cover him tracks.

Nigeria banking system dey very doll. This one Na to show you how lousy our financial system dey. That is to tell you say our money no dey safe for this bank their hand. If one person go ft hack this kind amount of money comot, that mean say our fund no dey safe for their hand. So this now dey point hand on investing our fund on crypto wallet because e dey difficult to access am, on like local bank.

2. Backwardness of our country in terms of blockchain education because no information from Accessbank whether dem contact Binance exchange to see if the USDT dey there so that Binance go freeze am.
Na because of their backwardness in blockchain technology naim cause this thing like this. If had it been CBN no put that ban on crypto, I think them for dey farmilar and conversant with this transaction. Rather them find am strange. who knows if Dem hire a cryto guru wey even help then trace how them even use the money buy ustd. if not why e delay reach 8days?

I doubt if the hacker go dey that stupid to leave the USDT on Binance exchange. After buying USDT from the traders, it's either him send am to him personal wallet or buy Bitcoin with it. If him send the USDT to him personal wallet, access bank go fit contact Tether to freeze the funds, but if him buy Bitcoin, dem no go fit really do anything than to the monitor the address. If him buy Bitcoin and send am to a mixer, the fund is gone forever. On a second thought, I come dey reason why the hacker buy USDT at the first place when him supposed buy Bitcoin and mix am. E fit be say the hacker don jonse and na something wey Access bank supposed capitalize on, instead dem dey busy dey chase and freeze innocent traders accounts upandan.
Naim be the only thing them fit do Na. Blocking innocent  people account. When you dey look for a criminal you come find person wey resemble the actual one, him don become suspect be that Na.
Pages: « 1 [2]  All
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!