Bitcoin investment dey very important for this our society and any person wey don get the knowledge of bitcoin and invest go benefit from bitcoin.
I dey sabi see this thread for this forum wey people dey compare real estate investment and bitcoin investment, even for social media most people dey compare this two sometimes but I see no need comparing the both because both get their differences. But for me as a Nigerian I think bitcoin investment is very important so I will choose bitcoin investment. Bitcoin investment na 50/50 but I still prefer bitcoin investment and any person wey reason this matter for Nigeria go prefer bitcoin investment.
Reasons why bitcoin investment is important in Nigeria:
Firstly let me compare the issue about real estate investment and bitcoin investment.
- before owning an estate, we need to consider the land and most land for Nigeria dey very low due to the nature of the land, so person wey wan buy land for estate investment needs to consider this factors, like for my state the land them low wella so any little rain water dey come underground for some area and people wey find themselves for this kind area and them wan build estate how person wan do?
- flooding for Nigeria na the common thing wey dey affect houses but I thank God say this year the flood wahala no come. Everybody know say when this flood don come e dey enter houses and e dey affect estate (building) and e dey affect estate owners too because people go pack out, but in my own view na investors dey face the major challenge.
- After this flood the house no go get beauty again and the house no go dey attractive and estate owners get bring back that beauty of the house with huge amount of money like painting the house
- Secondly most people no go like to live for area wey dey flooded every year because of the stress of packing and other things so why not find another estate wey no dey flooded, me personally if I find estate wey flood dey enter every year me self no go rent that house because I hate stress, how do I mean by the stress, most people no sabi swim for this country and in times like this things dey happen even who sabi swim is not advisable due to the erosion so is better to avoid flooded areas, so if everybody dey run from flooded area/house how the investors wan do and this na the common challenges estate owners dey face for Nigeria that's why I prefer bitcoin investment cause is more secure and safe. No be for only naija other countries wey dey engage for war and fight, bringing down of buildings with bomb etc. Just like the war going on in israel and Palestine, so for that kind country I no advice any person to choose real estate investment
- in Nigeria, mostly my locality, estate investment is not lucrative and as I said, there are many factors that affect estate investment, hotel owners in my city are also complaining the low patronage by customers, therefore bitcoin investment is preferable in this generation.
While bitcoin investment has to do with you and your money no other person to control your money. The only thing person need to know before investing na to get knowledge of bitcoin/ investment, how to secure your seed phrase, keep your bitcoin holding a secret, stop following social media influencers trying to advertise crypto(bitcoin), ignore unknown contacts discussing about bitcoin investment. Bitcoin investment has to do with
privacy and smartness.
I saw a thread talking about bitcoin investment and Dangote, saying if Dangote had invested on bitcoin earlier he would have been the 6th
richest man in the world and that's just the truth, but as I reason this matter no be only Dangote, our politicians too. Naija politicians na people wey sabi hide their wealth normally EFCC no dey allow them rest when it comes to property and wealth, we fit testify say most of our politicians has been arrested just because of their wealth and just if our politicians can invest half or little of their wealth on bitcoin it would have been better rather they keep using dollar, I see bitcoin as a private investment, if you no tell person, person no go know so I don't think EFCC can verify these politicians money on crypto(bitcoin), I don't know if our politicians have the knowledge about bitcoin cause I made my research and I saw a news where ex vice president professor Yemi Osinbajo was addressing Nigeria government not to ban bitcoin but bitcoin should be regulated.
Even if CBN government no wan accept crypto(bitcoin), they cannot change the fact that Bitcoin as a decentralize currency is more better than fiat. Nowadays we don't trust bank workers anymore, sometimes I see stories online how bank workers scam customers