~
E don Tay, wey I hear about that hive website, and I get some guys Dem wey be members of that website. The website wan dey similar to btt or other cryptocurrency forum, but e majorly na blogging and for people wey Sabi write. Them no majorly dey base on any particular discussion but anything way concern money, economics, cryptocurrency, sport and even government.
Last I remember, the website get them own coin, wey you dey receive from up vote, wey any member give your for each post wey u create and e make sense. Them go then convert this up vote to money and then to them coin, Wey you fit sell for coin market.
That time, I be dey try understand how tins dey work for there, but Dem system too hard and any small mistakes you make, your account don go. I remember a friend wey mistakenly loss e private key wey Dem Tay dey login and control account for e hive. E try e best but till now, e money and account don go Dem no fit retrieve am. As you dey create your account, Dem dey give you some important keys make you store. The one to tay login and to tay withdraw from your money wey dey there.
Sha the website be make sense but Dem matter hard. Dem even recently update Dem earning condition and na people wey don Tay na go fit benefit from am. Sha if you wan try am, no wahala but you go ready to dey create even more correct post for that side compared to watin we dey do for BitcoinTalk.