Some of our childhood stories for primary school bin dey entertaining but, we no know any lesson to learn untill we become adults.
One regular primary school short story bi say, snake and frog bin dey as friends for long time. E reach one day, snake born male snake Wey go become the friend of frog pikin.
Dia friendship come dey like brothers , Dem come make vow say, them no go eat each other but , one day. Hunger come dey the town, so the snake son go meet him mother say , him dey hungry.
The snake mother tell her son say, your friend na good food , so eat am , you no go hungry for two weeks. The snake mother tell her son say, she and from mother bin dey as friends , one dey the same hunger hit the land Wey make her eat her friend and she no come hungry from two weeks.
The next day, snake come tell frog say make we go stroll with the plan say , from there him go eat him friend. As the two of them dey stroll , frog notice say, snake movement dey fast, frog come suspect so him sef come increase him jumping speed .
Na from Dia them come pursue each other untill from jump enter water with grasses. Snake enter the water come notice say na float , by dat time, frog don swim from under water go hide.
Snake come wait till evening thinking say frog go come out from the water for him to eat but, frog no come out so him go home hungry.
Na from there dia friendship spoil. But wetin be the lessons , enemy Wey dey behave like friend must be watched. Your best friend go betray you when him face problems or temptations. Say be careful and observant when you dey among your friends.
Please share your primary school short story
With forum members.
Do you really know the purpose of this forum? This is not a place for cheap stories bro, this is a place for serious mindedness and people who are ready to learn and contribute towards Bitcoin knowledge. Nobody is in primary school here and such posts may not be necessary here. Let's listen to what the high ranking members has been saying about keeping this place free of shit posts.