Well OP this village people matter enter my head self ohhh almost everybody for my village no come back Xmas last year almost all the house just dry.
But still if village people wan follow person no where is to fall for them ohh,na to just Dey use God and pray hold body ohhh
Those people no get joy ohhh I com they ask self wetin Dey Dey see for person body self me wey no get money self just for some Xmas clothes wey preson buy, they com thinks say person get money, then go com do meeting for person head.
No be everything way we go just carry hand over to prayers oooh, some times nah we way be person they carry our hand our self for trouble, eh they make sense say person way wan go home or anywhere at all way him wan go make him mind him business and first protect your self with your own hand mind where you go and how you waka the kind of people way you link up with, no be only village bad people they and me I no even believe on that thing way dem they say evil person use charm do this and do that all those things and just Watin the person way wan believe am they believe eh no they pass so.