|
January 28, 2024, 05:55:26 PM |
|
The break up matter no be only celebrities dey experience am, e dey reach everybody like breakfast. The point wey you torchlight make sense but I just want add say wetin dey also cause some of these break ups na peer pressure. Some celebrities dey rush into marriage, dem no dey take their time check the partner character before them settle down.
Another thing wey dey cause break up na abuse. The man fight act all nice and later him go turn tigger dey punch him wife like punching bag. For example if the late gospel musician wey sing Ekwueme been break up when the husband dey abuse her, e for dey good. So any person wey go break up because of abuse, I support am because life matters.
|