Bitcoin Forum
June 25, 2024, 09:54:07 AM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: « 1 [2]  All
  Print  
Author Topic: My advice concerning the new trend (No gree for anybody)  (Read 189 times)
Ever-young
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 1218
Merit: 193


View Profile WWW
April 27, 2024, 08:21:58 AM
 #21

Every slang when burst out for we country de always push us to be better. E get one when make me like this no free for anyone slang and na when this our condoan, Mc Monica been visit bovi for him house and bovi grit everybody come to leave de guy and him grit am, the guy man call am back tell am plain say him de hear oh and from their then come even exchange pleasantries.

The main koko be say make we no play oh, no gree for village people, no gree for yourself, no gree for sleep and no gree for any setback.

This na the right mentality when we need use start the year and e go better prepare us for whatever lies ahead of us. We mauve.

I totally gree wetin u talk, every slang wey dey come out for our country dey ginger us or dey make us discover our potential powers or abilities wey dey inside us and e dey comot laziness from us self. So this no gree for anybody wey come out like this, dey really sweet me for body o, because I dey see plenty people wey dey hustle hard, dem dey very handworking now, just to make a living and to make sure say dem no fit beg again or depend on anybody again, everybody won become boss man and boss woman and nobody won become a slave again, plenty people eye don open finish, nobody dey depend on government, even if dem no get plenty but at least, dey won dey comfortable with their life and na wetin dem dey try do to maintain than standard, infact I'm in love with this slang.
Pages: « 1 [2]  All
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!