I observe say other local boards, na dem local language dem de use, even di ones wey get dem own alphabets na im dem de take post too. So I see am say e get as e be, when we use normal or standard English, post for di main boards, we go come use di same English, post for our local board.
This thing wey you talk na the real matters, I be person wey no dey too like expose the bad bad thing wey dey we country and if we dey continue to dey write with normal English all this oyibo Dem wey dey here go dey read am dey think say na our country wey bad pass, e go really dey good if na only we we dey understand wetin we dey post for our local board concerning our country because even us too no dey understand wetin other country people dey talk about and I dey see am say Dem no really they gbedu us because Dem dey think say all of us na scammers so e no good for Dem to dey read and understand our posts make e no make matters worst.
E dey pain me as I dey see post wey dey condemn us and the writing go come be for normal English, I understand say no be everybody for we country Sabi use pidgin but at least as Dem dey post make e no dey paint us black/bad to other country eye. Las Las I dey in support of pidgin English for our local board make e dey in favor of everybody.