My pipo Una well done, I sure say all of us don dey aware say of how different types of the wahala of scam dey come out everyday world wide but the good news be say information and better updates of how all dis scammer dey carry out their scam dey reach us for internet and I sure say many of us self don get first hand experience put.
So today I just say make I enter twitter check for news way concern this our bitcoin as e dey good to always dey updated as I dey scroll I can see one scam about P2P on bybit I know say this one no be the first issue way dey happen for bybit but I just still say make I can share am with Una for this our Nigeria local board make all of us for dey updated
De question now na how dem take dey do am ?
Dis scam now na about fake alert scheme way all dis P2P vendors don dey use for exchange This one do go initiate the send then off their data once dat way, Ur bank go alert receive incoming transfer but when you check no money go actually come so e go show failed na example of watin I dey talk so dey this link .
https://x.com/shalliiswago/status/1953207753352098241?t=FBoyuJcpvEEwg5Xhw3y52Q&s=19https://www.talkimg.com/images/2025/08/07/US2RJ2.jpeg[/img]
[img
https://www.talkimg.com/images/2025/08/07/US2Tbc.jpeg[/img]
So waiting I dey try talk be say make we dey very careful when we dey do transactions wey concern P2P and before we go release any of our coin make we first confirm say we don see Money for account Nia make am e no good to dey rush dey do something especially when e concern our coin . Una thank you for Una time make all of us stay informed with scam make we no fall victim.