E better to be doing long term Bitcoin investment than short term investment called trading. Even if you are doing short term investment / trading, it's important that you are also holding for long term investment. The risk of short term investment in Bitcoin is not for the weak.
Trading is different from short term investment. If na trader u be, make u know say na trading even Dey risky pass because u go need they monitor d market well. But if na short term investment, that one Dey range from 3 months to 12 months, I no Dey advise people make dem invest in bitcoin for short term investment, e Dey risky also, because within that period wey u go Dey hold bitcoin, d price fit never rise, and don’t be surprise that bitcoin price still fit Dey down that period, and if to say u wan use d money, u no go get choice than make u just sell the bitcoin.
If u wan invest, e better make ur target just be long term investment, if u fit hold bitcoin for long term, then make u know say u go enjoy d money later in d future, but u go just make sacrifice for now.