Na oyinbo teach Naija ma scam na just say Naija pipo too loud,if not we no go dey bugga with scam. Naija dey learn for where those oyinbo dey all the best hackers no be that side e dey,moreover na them provide tools wey we dey use. All the btc hacks wey we don hear for forum,e no relate to Naija at all. My pple ma we no bother ourselves, we still dey learn for where oyibo dey. I guess because say Naija pple dey every country wey you go than any Africa country citizens na e make dem dey give us the charge.
No matter how e be, I no go ever see my people as bad people. We Nigerians na very good people, people way sabi care for one another especially when we meet for another man land, people way like jolli with ourselves and na so we sabi play kwa. E just dey unfortunate say, people way put magomago for ours system and way dey direct the evils way don turn our government to dey this corrupt no go ever commot for our body. Them don be sucking blood way don fatten up inside our skin so tay, them don big pass the hole way dem follow enter before
We no own scam, we reject am in everyday and that's why, we dey try everyday to teach our people say, e no good and our government no smile with am at all. We go dey clean our house and make them way dey tag us try clean therr house too. Na there dirty don fine us come so.