One of the reasons be say, binance been de one of early exchanges to be launched, which they launched in 2017, that time wey crypto currency still de grow, so with this, they were able to pull a lot of crowd to themselves
Binance wasn't the first or even one of the first cryptocurrency exchange to come out, we get plenty sites dem dat year wey dey run Bitcoin exchange. Wetin blow Binance na say 2017 was the year of the rise of altcoins and dey came into the market with focusing on provided trading ground to altcoins but other exchange na Bitcoin dem dey focus on and to list altcoins was war. I remember when exchanges lik bittrex go dey do guy when we dey beg dme to list a particular altcoins but Binance go run am asap. Binance no play with their plans and na so so competition you go dey see the platform as per trading competitive wey dey attract traders.
Also the user interface was crazy compared to wetin be dey before, binance come into the industry with full force and dem come even add their own coin Join. I think na Binance first introduced that exchange coin thing and dem be come run ico wey dey hot that time like mad. Na Binance make exchanges begin take customer support serious and begin listing altcoins which started the whole altcoins season wey we dey hear so. I think the most important thing na say, binance no joke with their customers and dey steadily run innovations as new things dey enter the industry like lending, staking etc.