I will advise you to change that Bsc address and use Electrum bcos there are some apps dat bring up unnecessary adds to wallets.
If you check the account well, you go see say him dey use the account for bounty, I dey sure say na for spreadsheet dem copy d wallet dey come send d token to random people. You no expect say person wey dey use account do bounty go dey use electrum wallet now, na the best wallet wey him fit use for bounty na Wetin him don dey use be that, the only thing wey him go do na to no just swap those tokens make him just leave them like time, i dey sure say with time him go still receive more tokens.
Those messages they are sending are from scammers and if you click any link there the coins which you have in your wallet don go be that.
If you read the post again, you go see say no be message d Op talk say him receive, so no be link him talk say him receive, na tokens him talk say him receive for him bsc wallet, and I no dey sure say dey fit attach link to the token wey dem send to wallet, so make u just check am well again.
As 4 me I never see am before so knowngunman dey say na normal something sef, I Kno Kno am.
Na true knowngunman dey talk, like say you never run bounty before, if you don run bounty before you go understand Wetin knowngunman dey try talk. If you dey do bounty e dey normal say you go see those kin token for your wallet, but make we no just swap am ooo.