If I go fit agree with some of the things way you talk, but I go totally disagree with the topic of this discussion because for 9ja nah only those pipo way no know there way and how to do this nai e dey dey so hard for dem to become successful.
Na lack of information dey make some people think in certain ways. I wonder why person go talk say to become successful in 9ja dey very difficult when opportunity full everywhere thanks to our population and freedom wey dey the country. Check how many people wey don take entertainment blow, abi na youtubing, coding and plenty other areas boys take dey meet up for 9ja. Like I said before, na lack of info dey bring some kind reasoning.
You know say some pipo for this we country, as dem done see say the country hard so, dem just lose hope to make am for life but my GE, make I tell you say as 9ja hard so, we still get some pipo way dem still dey progress, 9ja as e dey naw, nah to apply wisdom to ram, if you look well you go observe say, this time around nah pipo way dey use sense dey do their things nai dey progress pass those way dey use their whole strength do things.
True true 9ja no dey carry last but we gass apply wisdom first.
For business pipo, if them dey into this business and things change for the business, make dem try change to other business too.
Plenty of our youths them want am sharp sharp that is why you see them not committing time to do something that will take them time. Now na truly the time of working smart.