If e happen say true true the guy die and camera dey somewhere wey capture everything and all the people wey dey near the area as e happen... and e come be say you comot for the area run go your house, base on Nigeria system, you dey free or you no dey free? If the person no dey free, wetin be the right thing wey the person suppose do? Remember o, them never confirm say the person don die... you just observe as they knack am and as him no dey move or talk again, and you take off immediately.
Forget sey camera dey the area, you no join hand beat the thief or shout thief thief na, so why u no go dey free? and the camera sef no fit they work no be naija again
The matter dey simple so no worry yourself
Even if na for America wey camera dey full everywhere the matter take happen you are free they go just call you for some questioning since u no join hand for the matter except if you know sey you do something.