Bitcoin Forum
May 21, 2024, 06:40:19 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: « 1 [2]  All
  Print  
Author Topic: We suppose use pidgin English de post for our local board.  (Read 219 times)
AmaGold70
Jr. Member
*
Offline Offline

Activity: 46
Merit: 4


View Profile
April 16, 2024, 10:30:35 PM
 #21


I observe say other local boards, na dem local language dem de use, even di ones wey get dem own alphabets na im dem de take post too. So I see am say e get as e be, when we use normal or standard English, post for di main boards, we go come use di same English, post for our local board.

This thing wey you talk na the real matters, I be person wey no dey too like expose the bad bad thing wey dey we country and if we dey continue to dey write with normal English all this oyibo Dem wey dey here go dey read am dey think say na our country wey bad pass, e go really dey good if na only we we dey understand wetin we dey post for our local board concerning our country because even us too no dey understand wetin other country people dey talk about and I dey see am say Dem no really they gbedu us because Dem dey think say all of us na scammers so e no good for Dem to dey read and understand our posts make e no make matters worst.
E dey pain me as I dey see post wey dey condemn us and the writing go come be for normal English, I understand say no be everybody for we country Sabi use pidgin but at least as Dem dey post make e no dey paint us black/bad to other country eye. Las Las I dey in support of pidgin English for our local board make e dey in favor of everybody.
Kelward (OP)
Sr. Member
****
Offline Offline

Activity: 406
Merit: 263


Eloncoin.org - Mars, here we come!


View Profile
April 17, 2024, 09:26:00 PM
 #22

Of course nah true, mk e easy for everybody especially as they say no  AI because no be everytime e dey dey person body to speak correct English, mk person no write wetin e no fit explain but as local board dey like this, person fit dey speak pidgin as person, e good to free urself in a way we can because e dey reduce mental stress for us, so for us to express ourselves and all that mk we just dey use pidgin language foe here wey be local board so that person no go get unnecessary headache and e dey also help person to understand more about this forum too and also e dey help to aquire more knowledge from other people and here be like update station.
Because of dis pidgin English, wey de allowed for dis our local board, na im de make me to de look forward to de come here to make posts and free myself, freestyle with di language wey I de very proud of. But dat one no mean say I beta pass our members wey de flow with only correct English for our board, because no be everybody sabi flow in writing pidgin English, or some fit no like di idea of writing in pidgin, di important thing be say we de understand each oda. I de feel at home for dis our board because na we we de for here, one love to dis our naija board.

Pages: « 1 [2]  All
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!