I know say this local board done really try to unite us and from the way our snr bross dem de take contribute for the forum na serious motivation to us when face never show to put in more effort to ensure say wetin we de create de of high quality but as e take concern if e de necessary to get physical meetup where we go fit;
1. Building a physical community of bitcoineers so we fit talk about the trends and share ideas on the possibility of adopting bitcoin for we country
2. We fit still use am share knowledge so the younger ones for this sector fit learn and we fit also still use the medium network small.
3. Organise seminars when fit focus on global trends and also share opportunities in the bitcoin world.
I no know if this one go de reasonable for us oh, I say make I yarn am so we fit put mouth reason am together.
Well no be say na bad idea you talk o, but I no sure say e go dey possible. For many members here for we local board Dem no go fit expose their identity. Even me self I no go warn come that kind seminar Because you know very well say we country no good and no so so bad things dey sub with many bad people Dem every where. Since I dey into this crypto matter, na only my friends Dem na know because them too still dey do crypto. Now imagine say den con organize such gathering and some bad people Dem con follow come all the people there go dey in danger because them go dey reason say since na Bitcoin all of una supposed get better money.
The forum get everything wey we need to learn for here and I really no see watin we wan come learn pass this one for that kind seminar.