Bitcoin Forum
May 21, 2024, 11:53:47 PM *
News: Latest Bitcoin Core release: 27.0 [Torrent]
 
   Home   Help Search Login Register More  
Pages: [1]
  Print  
Author Topic: As e be say theymos don ban mixers make we follow instructions  (Read 46 times)
Richbased (OP)
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 308
Merit: 172



View Profile WWW
December 30, 2023, 10:24:48 PM
 #1

This one na just to alert dose of us wey dey Mixers campaigns say the countdown to the ban na just one day left as in be say oga at the top we be theymos don say make we no dey promote mixers or write anything concerning mixers make we try to obey the instructions because me I believe say na for the good of the forum wey make him take that kind decision so anything wey so make this forum to dey under target by the government make we remove our hand because normally government dey find where faults go dey so that e go come be like say na In make Dem take the action and imagine if Dem come succeed shutdown de forum you and I know wetin in mean be that so abeg people wey dey wear avatar and signature of mixers make una try remove am tomorrow to avoid story dat touch because me I no go dey happy say one of us for here receive negative trust or tag because of carelessness so anyhow wey e be make we dey watch each others back and be our brothers keepers if you go to some local board like the Indonesia board you go see too many legendary wey gallant for dia so na base on their cooperation and understanding among themselves na in make e dey so, so make we try to dey assist ourselves to grow because na in be d only way we go achieve a new Nigeria.

Makus
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 336
Merit: 232

Bitcoin!!


View Profile WWW
December 31, 2023, 04:46:20 AM
 #2

I reminder na better one, the mixers ban na very tragic change wey sup for this forum but, if we look well na just for the continuous running of this forum, just like the op talk, e better make Dem remove this mixers than make the entire forum shutdown. So abeg to all those people wey dey mixers signature campaigns, make una do pull una signature commot for body so that we no go hear say one of our own go chop red tag because of disobedience. If that kind thing happen, e no go tell good on us, outsiders go dey us like people wey like to disobey orders, and that one sef fit make baba Theymos delay for the things wey we dey ask am.
Gozie51
Hero Member
*****
Offline Offline

Activity: 2492
Merit: 624


Leading Crypto Sports Betting & Casino Platform


View Profile
December 31, 2023, 06:15:57 AM
 #3

Theymos don already set the rules to follow and campaign wey dey run under mixers don already pack out from the forum. So na who get ear make him hear, na fly wey no want hear word go follow dead body enter grave. Na the thread be this for people wey never grab the gist .
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5476162.0

..Stake.com..   ▄████████████████████████████████████▄
   ██ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄            ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██  ▄████▄
   ██ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██████████ ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀ ██  ██████
   ██ ██████████ ██      ██ ██████████ ██   ▀██▀
   ██ ██      ██ ██████  ██ ██      ██ ██    ██
   ██ ██████  ██ █████  ███ ██████  ██ ████▄ ██
   ██ █████  ███ ████  ████ █████  ███ ████████
   ██ ████  ████ ██████████ ████  ████ ████▀
   ██ ██████████ ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄ ██████████ ██
   ██            ▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀            ██ 
   ▀█████████▀ ▄████████████▄ ▀█████████▀
  ▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄███  ██  ██  ███▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄
 ██████████████████████████████████████████
▄▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▀▄
█  ▄▀▄             █▀▀█▀▄▄
█  █▀█             █  ▐  ▐▌
█       ▄██▄       █  ▌  █
█     ▄██████▄     █  ▌ ▐▌
█    ██████████    █ ▐  █
█   ▐██████████▌   █ ▐ ▐▌
█    ▀▀██████▀▀    █ ▌ █
█     ▄▄▄██▄▄▄     █ ▌▐▌
█                  █▐ █
█                  █▐▐▌
█                  █▐█
▀▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▄▀█
▄▄█████████▄▄
▄██▀▀▀▀█████▀▀▀▀██▄
▄█▀       ▐█▌       ▀█▄
██         ▐█▌         ██
████▄     ▄█████▄     ▄████
████████▄███████████▄████████
███▀    █████████████    ▀███
██       ███████████       ██
▀█▄       █████████       ▄█▀
▀█▄    ▄██▀▀▀▀▀▀▀██▄  ▄▄▄█▀
▀███████         ███████▀
▀█████▄       ▄█████▀
▀▀▀███▄▄▄███▀▀▀
..PLAY NOW..
Obim34
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 252
Merit: 225



View Profile
December 31, 2023, 06:45:17 AM
 #4

This na good reminder to these our brothers wey still dey wear the mixer avater make dem no forget wetin @Theymos don talk about am e no for good make anybody forget to remove him avater before the end of today as e fit cost the person account.

E sure die say we go still see people wey go come beg for reputation board due to disobedience normally some go claim ignorance but just say make non of us here be victim, red tag from @Theymos na same thing as being banned.

Mayor of ogba
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 308
Merit: 186


★Bitvest.io★ Play Plinko or Invest!


View Profile
December 31, 2023, 08:27:52 AM
 #5

Op thank you say you don remind people wey they promote this mixer through signature say time don they close for them to remove anything wey they related to mixer for their profile. If you open this forum you will see where then write mixers will no longer be allowed after Jan 1st. But make we no allow make e reach Jan 1st before we go remove the mixer signature avatar and write-up from our profile because we know how our matter be for this forum.

Jegileman
Full Member
***
Offline Offline

Activity: 350
Merit: 184



View Profile
December 31, 2023, 09:18:57 AM
 #6

Good reminder for the local board members and make we try follow the rules of the oga kpatakpata for the forum. I know say anything wey him dey do, na for the good of the forum, make we no take am harsh and follow up the rules judiciously. The kind rules wey dey bring up for dis forum about mixers, e go better make person no even dey write d word mixer for forum make person no come do mistake break rule come receive ban for here. Las las everything go better and we go see better things ahead for future for the forum. Make next year better pass dis year for all of us for here.

Pages: [1]
  Print  
 
Jump to:  

Powered by MySQL Powered by PHP Powered by SMF 1.1.19 | SMF © 2006-2009, Simple Machines Valid XHTML 1.0! Valid CSS!