Well I thought I should give everyone especially the naive and new ones like myself a heads up about this particular news of how it can be used by scammers to achieve their mischievous plans and also everyone should be on guard because even the bankers themselves can be a big partakers in some crypto(Bitcoin) that happens in the bank.
You do well because no be lie say this news wey we dey consider positive news fit turn to something else as scammers go misuse the opportunity take target gullible users and from the high rate of the scams involving Bitcoin or cryptocurrency, e fit make the government ban the currency again with a more reasonable excuse this time. When the government been ban the banks from interacting with Bitcoin, it was technically like Bitcoin was banned in Nigeria so scammers no fit use say their business wey dem dey promote with Bitcoin dey registered for the country but as the ban dun go, dem fit dey come with that leg so na for we to not take anytime them say serious.
We need verify any business wey claim to get licence for Nigeria to operate any investment business or other business wey scammers fit dey wan use to scam us.
Note: beware of strange calls and claiming from different person claiming to be specialist in handling crypto transaction inside the bank because some of these might be there to cheat you in any way possible.
This and also those calling to introduce you to an investment that they'll claim are affiliated with the banks when na just scammers trying to scam you, plenty new tricks go come out and also some old ones like doublers go dey come out too. Make we dey careful and ignore all of them so we no go be the next story of person wey scammers defraud.