e go good say we talk am out so dat oda people go folo you happy too and e get one talk wey e be say "a closed mouth is a closed destiny" so as you dey talk out wetin you don achieve since you find your way for the forum, na so e go also open way for more greater achievement to dey come your way.
My broda, this your quote way you use here eh, I fit tell you with plenty confidence say, you use am wrongly o. Closed mouth being closed destiny, na when person Dey suffer and e Dey under subjugation then, e no fit or gree cry out. E Dey completely different from people coming out to tell the forum say, eehh, I don archive this one for life or since I come forum.
Omo, no be so e Dey be. In fact, things like this no be watin you go just come Dey announce to everybody. Naaahhh, you no go open yourself to people you no sabi like that.
If e Dey you okay, you fit Dey run am like that but, nothing spoil, people Dey reason different and I respect that wella.