My fellow country men, we know how this things dey be for the country, e no go Tey now one new ponzi scheme go come out with their own offer, and you go see say many of our brothers go fall inside.
I know say many if us here know this things, but the things wey dey attract us fit dey different too, very soon one new crypto go come out, all of Twitter go dey shake, one Influencer now go carry am for head, you no go know say nah better rug pull dey wait their or pump and dump.
Una remember the story of squid game, how they just come out with hype carry people money run. I no go fit advice say make una invest in only bitcoin, but make una try do good research, infact if possible pick only 2 altcoins invest in. But know say na only bitcoin wey dey fully guarantee.
Abeg my people make we no go give any body Free moni, besides Niger men we wise so make we apply that wisdom, even for our crypto journey too.
Make I no talk problem no come give the small solution I know.
How to identify this their scam people wey come in form of ledgit crypto👉 Read white paper: crypto project normally suppose undergo stages of development, so this project they get watin them dey call white paper which dey contain the formula on how the system go dey operate, their road map, e go explain how the entire network suppose function.
Any whitepaper wey u read wey no dey solve any problem, wey just carry promise full inside my brother commot body. The one wey we sabi bitcoin, give us proper written whitepaper. So any one wey no dey follow in the footstep na scam.
This scam people their whitepaper dey poorly written and if u sabi the eye read am u go know say na scam. Make I drop Link for better whitepaper so u go understand me.
BITCOIN WHITEPAPER👉 Identify team members: most of this scam people dey like dey anonymous for their work, so one good way to check for their team members, find who dey real their fir goggle or not, even follow them for Facebook see if the real person dey post something related to the project. And they no fit scam with theri real face cause government go find them.
👉 beware of free things: most of this men dey like offer free things like say na ponzi, them go carry token give you for free or even some of the extra prelaunch coin for free. Carry for mind say nothing be free oh, unless watin then go gain go big pass your own.
👉check watin them dey talk: one thing I believe na say good business dey out to solve problems, so if this people just come dey talk moni moni my brother commot body na scam. This people fit even go as far as saying them dey launch for 20$ when their presal3 na just 0.003 like how which kind lie be this or even dey promote themselves as the next big thing. Just dey careful of such.
Like this I know say I don do better justice to this matter any body fall na en own.
If you get other ways wey u know say we fit use avoid this scam wey go happen this year abeg share for us.
have to leave a system of investing base on influence[Suspicious link removed]agien having a influencer creating a content about cryptocurrency investment.most Nigeria will fall for the trick thinking it?s legit,without background checks and information and knowing most of the influencer are been paid for there services also.so I advise both the influencer and investor to be sure about any cryptocurrency investment platform before taking a step to want to invest in.