|
February 20, 2024, 08:08:15 AM Last edit: February 21, 2024, 10:54:52 AM by kenpachiofficial |
|
My fellow Naija brothers and sisters as e be so dollar don reach 1700 today, as at this morning wey I check my binance rate na 1738. Country sad, government sad, things cost but life goes on. I urgent everybody make them find ways to earn in $ because Omo, this our currency na rubbish currency wey just the fall everyday.
You no fit the earn in naira wey you go get peace of mind as things be, except your papa na politician sha even we wey the earn in $ e get as e be. Based on how this country don tire you I urge everybody make them find way earn in $, Twitter dey pay, affiliate marketing dey pay, forex dey pay, freelancing dey pay. Plenty things dey to get money from, I no advice make you do yahoo but if na that one be your calling then fire the go since government ma no send anybody. Follow who know road, this no be time to dey idle use your head well.
And as you the follow who know road, know who you the follow, e get why. BTC
|