Original post by RickDeckard :
🥧 Bitcointalk Pie Baking Contest - 2nd edition 🥧
Welcome to d second edition of d Bitcointalk Pie Baking Contest!
I no really think say d first edition of dis contest go for get any recognition when I first share d idea[1]. well I give thanks because I dey happy to see say last year own get correct number of turn up and e even pass watin I be dey expect. I see am as correct success but na d community na e make dis one possible. I thank all of una.
dis year, I get another challenge: to make am better pass last year own. make I no waste time, I dey happy to tell una say d second part of the Bitcointalk pie baking contest don dey live!
d reason for d contest na still d same- Celebrate d famous pie day but instead we go change d pie with our beloved Bitcoin symbol.
Prize:price no go dey for d 1st, 2nd and 3rd place dis year. as some feed back wey come last year, e go good make people Dem fit vote pass one entry. to even add join, I believe say dat one go make sure say no vote waste. to make sure say balance dey between to rank submission and make sure say every vote count, dis year d voting system go dey based on
single vote system we Dem fit transfer. you fit see example of dis method for [3].
we go equally distribute d total amount of Bitcoin wey we gather for dis event give d top three pies wey Dem vote for.
as e be last year, everybody fit add join d prize pool. if u wan add join, you fit let me know make I for update dis table below. for now, d prize wey dey ground na:
(collectible) new prize don add join for 10th of march:d correct art work wey
1Dq post, don give me sharp idea of another prize- one competition inspired collectable, wey dem make together with 1Dq! we go keep d art work secret. na only me and 1Dq go know d final result. dat wan be say, until d winner don receive am and maybe post am.
see d main information:
- Canvas size: 30x40cm/12x15in (frame no dey included)
- d pool of winners for dis collectible, go dey among d three person Dem wey go share d podium;
- we go choose d winner of d collectible with bitmover Bitcointalk giveaway manager;
- if d person wey win, no gree carry d award, then we go make another draft con use d same tool for d remaining 2;
- if no of d winner gree collect d award, den we go use am do giveaway for d rest submission for d contest..
- we go repeat d process, until person gree accept d collectible
Prize Pool:╔ | ══════════ | ╦ | ══════════ | ╗ |
║ | Username | ║ | Amount (BTC) | ║ |
╠ | ══════════ | ╬ | ══════════ | ╣ |
║ | RickDeckard | ║ | 0.003 | ║ |
╠ | ══════════ | ╬ | ══════════ | ╣ |
║ | PowerGlove | ║ | 0.003 | ║ |
╠ | ══════════ | ╬ | ══════════ | ╣ |
║ | UserU | ║ | 0.001 | ║ |
╠ | ══════════ | ╬ | ══════════ | ╣ |
║ | apogio | ║ | 0.0016 | ║ |
║ | Total | ║ | 0.0086 | ║ |
╚ | ══════════ | ╩ | ══════════ | ╝ |
Contest rules:- you must make sure say na you bake d pie and d theme go be Bitcoin related. you fit check last year entries[4] if u no dey sure say ur own go qualify or not.
- as Merriam-Webster, tay talk watin pie be as:
a: food wey get something inside, like fruit or custard, wey dey inside small small cake (wey Dem bake or wey Dem put for on top of cake or even both )
- Dem no go count any entry wey no be like watin we mention
- for you to qualify, you go need to post picture wey contain your homemade pie + you go write your username and date for paper snap join. at least take 2 more pictures as you dey make am to make sure say no be buy you buy am.
- na only one submission per user(u dey free to add any number of pie for your picture)
- d competition go get two phase:
- 1st Phase - From 14th February (00:00 GMT) to 14th of March (23:59:59 GMT) : dis na when every body go fit drop Dem submission -> Live Countdown
- 2nd Phase - Voting go start from
15th of March to 29th of March (23:59:59 GMT). we go announce winner on d 31th of March.
- during dis phase, people Dem fit rank their submission based on watin Dem like reach four. you fit change your vote until d second phase finish
- users wey no support pass one entry dey free to vote only one. you just no fit pass d limit of 4(we go talk say submission wey rank pass d 4th choice no go dey considered).
- No sending of merit dey allowed from nominees to users wey nominate dem
- e no matter d submission wey we get, d prize pool go share among di winners.;
Who go fit participate & vote?:- Users wey get 30 merit (airdrop merit no go count) and 30 activity.
signature wey dey for d :dis correct signature wey @jayce make last year still dey available for use again.
Hero/Legendary:[center][table]
[td][url=https://bitcointalk.org/index.php?topic=5485091][size=2pt][tt][color=#e28424] ▄███▄▄▄███▄
▄█████████████████▄▄
▄▄█████[color=#e7a561]█[color=#ffd064][glow=#fff,1]████▀▀████[/glow][/color][/color]██████▄
█████[color=#e7a561]███[color=#ffd064][glow=#fff,1]█ ▀▀ █ ████[/glow][/color][/color]█████
▄███[color=#e7a561]███[color=#ffd064][glow=#fff,1]█████ ▄▄ ▀████[/glow][/color][/color]████
████[color=#e7a561]███[color=#ffd064][glow=#fff,1]█████ ████ ▐████[/glow][/color][/color]████
███[color=#e7a561]███[color=#ffd064][glow=#fff,1]████▌[color=#dd636e] ▄▄▄[/color] ▄█████[/glow][/color][/color]███
████[color=#e7a561]███[color=#ffd064][glow=#fff,1]█▀▀▀ ██[/glow][color=#dd636e]████▀[/color]▀▀▀▀▀█[/color][/color]████
▀███[color=#e7a561]███[color=#ffd064][glow=#fff,1]▄▄ ▀▀[color=#dd636e]██▀[/color][/glow][/color][/color]
█████[color=#e7a561]███[color=#ffd064][glow=#fff,1]█ █ ▄▄[color=#dd636e]█▄[/color][/glow][/color][/color]
▀▀█████[color=#e7a561]█[color=#ffd064][glow=#fff,1]███▄▄███[color=#dd636e]██[/color][/glow][/color][/color]
▀█████████████[color=#dd636e]▀[/color]
▀▀███████▀[/td][td][/td][td][/td]
[td][center][url=https://bitcointalk.org/index.php?topic=5485091][font=Impact][size=17pt][color=#b24e10]Bitcointalk Pie Baking Contest[/size][/font]
[i][font=arial][size=9pt][color=#000]Start baking and submit your entry until [font=arial black]14/03/2024[/color][/td][td][/td][td][/td]
[td][url=https://bitcointalk.org/index.php?topic=5485091][size=2pt][tt]
[color=#ffd064][color=#fff] ▄█▄▄[/color]▄[color=#e28424]███▄▄▄[/color]
▄[color=#fff]██[/color]▄▀▀███[color=#e28424]████▄[/color]
▄▄▄███▄[color=#fff]█[/color]▀[color=#fff]███[/color]▄██████[color=#e28424]█████[/color][color=#b24e10]▄[/color]
▄▄▄████████████████████████[color=#e28424]█[color=#b24e10]██▀
[color=#ffb30f]███████████████████████████[/color]██▌
[color=#ffb30f]███████████████████████████[/color]██▌
[color=#ffb30f]███████████████████████████[/color]██▌
[color=#ffb30f]███████████████████████████[/color]██▌
████████████████████████████▀[/td][td][/td][/tr][/table][/center]
Special thanks:[1]
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5438434[2]
https://en.wikipedia.org/wiki/Single_transferable_vote [3]
https://en.wikipedia.org/wiki/Single_transferable_vote#Example_for_a_non-partisan_election[4]
https://bitcointalk.org/index.php?topic=5444932[5]Banner image taken from
CryptoBriefing[6]Table design taken from Stalker template found
here. Thank you!
[/quote]
na AOBT na run dis Translation by Dem self