With the way country hard now and new jobs no even de come out like that, we no need talk am two times say make everybody secure wetin de fetch am money with the whole of him hand.
Work for dis country na Gold, if no be say you get better connection from above, baba nothing Dey ooo, so any one wey Dey, even if d money no too much, make we try hold am, at least half bread is better than non. Na before you go even Dey hear anyone say job Dey for sell, but now even that one don hard ooo, if no be say you get better connection, na scam dem go just scam you.
That job when you de look am like say nothing come out, if you know the number of person's when de pray say na them get that opportunity, e go shoke you.
People wey no dey carry there work serious, dem no go sabi the value of Wetin dem get till dem lose am. Seriously even if na small amount dem Dey pay for where you Dey work, plenty people Dey wey Dey fight for that kin job, and dem no get am, so any condition wey you find yourself, make you Dey thank God.