Congratulations boss abeg, you don do well to make this local board proud. Wining anything for international board mean a lot to this our local board, e show say our face show normally. I believe say if we keep up like this, in the next few years to come our board go dey very outstanding because of our doings. Make we keep the good reputation coming, because e go definitely take us to somewhere. Congrats to the other winners as well and to those wey no make am to top 3, una try. E no easy to get the courage contest for international board and come even bake untop.
No be small oo, we Nigerian are really doing well and I must say them don really dey fee the pressure sef because we no dey take last. Congratulations to agbe once again e no dey easy like you talk to make pie then come even win am in the first place so kudos to the good work and be rest assured to keep up the good work bro and we dey entirely for your back.