Just as Charles talk make dem start from the top begin to dey show workings and the moment people for bottom see wetin dey sup, dem go readjust.
As dollar don fall small, the price wey manufacturers dey pay to bring in raw materials into the country to produce their finished products don also come down. But if dem still dey sell at the old price to their consumers, then the price of things go remain the same, except dem don bring their price down but some greedy persons still dey make things difficult for others. Anyways, na good work from FCCPC, but make dem also spread their tentacles across other cities aside the ones wey dem mention.
E make sense as Dem don start to enforce the regulation of prices from the federal capital territory, because if Dem dey wait to start simultaneously for the whole country, e no go different from something like census or immunization wey government workers go dey parade everywhere with file and red marker pen to catch offenders.
Apart from corruption wey we dey fear to infiltrate the FCCPC, as long as say na now Dem begin dey visible to many of us and marketers, all eyes go dey on dem to perform and do the needful, because the economic hardship due to hike in prices of commodities and items for this country, touch everyone no be small.