Also remember the risk wey dey Airdrop, use separate wallet for Airdrop, observe well before you do anyone bcos some na waste of time.
Na back days na e I hear say Airdrop dey pay wella, but these days na scam airdrops na e dey wey be say you go carry out the task and them no go pay you or you fit no withdraw the funds. I know say airdrops no good but na how you go take know the right project for Airdrop wey go be legit. These notcoin people, you sure say no be just for the hype now wey bullrun dey around the corner, and them go make una do KYC wey them fit use that your own data for their benefits. I never see any legit one since I know about Airdrop last two years.
Oga as bull run don come e go dey easier for Airdrop to pay and nor be all these airdrops need you to do kyc, those way do Notcoin nor do anything like that.
Though watin you talk nor be lie, we suppose dey cautious of where we for dey put our personal information while many of these past airdrops, wey dey be like say them dey mine for phones dey ask for KYC, I never see anyone for telegram wey dey ask for personal information sha
For here we don already know why e good to invest in bitcon already but bcos of economy matter, we nor fit invest in bitcon as we want but thank God Airdrop and bounties don dey pay well again. We don see people wey dey cash out welll from them well well especially from the latest one wey be Not coin, people cash out well from m and other recent one like Ice and the others.
My advice be say make we nor dull put for Airdrop matter, do m wen the money come buy bitcon, nor go dey HODL Airdrop coins bcos most times the developers na to make money na concern them and so once the coin don dey listed they go sell wey them still cash out. Just take your cash out tel invest in bitcon so that go fit quickly reach your accumilation goal.
Also remember the risk wey dey Airdrop, use separate wallet for Airdrop, observe well before you do anyone bcos some na waste of time.
Hmm... You dey sure say as this one you dey refer to pay another one go pay? Economy or not we still get people for naija wey still dey invest for Bitcoin, the matter be say if you no get money make you no invest because the economy no dey stable again and as we country dey so, the cost of living done almost kill the living finish sef.
If you nor get money tel invest for bitcoin then you nor get any other option than to dey do Airdrop bcos na who fold hand go lose Las Las forthis bitcoin investment, after all we know say one go definitely pay but another thing na be say nor too deh expect much from Airdrop, just dey reason small wey over expectations nor go make you get disappointments. Na this kind way some tel start before them cor dey were them dey.
Anything airdrop matter, dey very risky, you fit take much time dey claim and and make you no dey surprise say at las nah ponzi schemes.
Airdrop dey risky no cap but one thing way you need to know about m be say e dey different from ponzi schemes, Airdrop nor need you to deposit money except you dey missed m as ICO wey dey different from m.
Though both of them fit fall for rug pull scam but na ICO people go suffer pass bcos those wey do Airdrop might only lost their transactions fee and this type of rug pull scam na honey pot scam while the ICO fit for many others including the honey pot scam. This na among the reason we need dey cautious of the Airdrop make we dey do though one way to know na how the dev tel dey act especially wen them dey promised say their Airdrop go turn person to millionaires