For example if you receive 130k a month and you invest 20k each every week, making a total of 80k per month left with 50k, that is a bad aggressive Investment and surely the person is over doing it.
you dey received 130k as salary and you come dey invest 20k weekly. How na? How do thing dey sound for hear na. Even the person is investing with DCA method, it should be monthly and those who are investing weekly are businessmen or those wey dey received salary weekly. Instead not the person nto invest 80k at once then he would be using 20k weekly, it does not make sense at all. Aggressive investment does not mean say you go invest big amount but how many bitcoin di person get foe him wallet na bi di aggressive investment. Like example. Oboy you dey vex ohh. You get dis kind of bitcoin in your wallet? That one nai bi aggressive investment. If you dey receive 50k monthly and u dey invest 20k monthly as your DCA approach and from there you don go acquire plenty bitcoin in your wallet then na aggressive investment be that.
lol… you self wey Dey try correct person never even sabi wetin you Dey talk here self. Which one come be say Aggressive investing na how much you get for inside your wallet?? Your example self come follow off me

My brother, aggressive investing na when you Dey invest aggressively (as the name sounds) just like OP talk, person Dey make 130k a month, and instead of to first calculate your expenses for that month before your next paycheck, you rush go comot 80k buy bitcoin, come Dey use 50k Dey guide for the month, meanwhile you know say 50k fit go finish for the 3rd week if you manage am well or if small foodstuffs Dey for house to take support am. Wetin you do like that na wetin them Dey call aggressive accumulation or investing.
And this approach Dey very wrong because you fit end up to Dey stranded before your next paycheck or salary go come and when that one happen, you fit go Dey touch your Bitcoin or go borrow money unnecessarily just to take survive, when be say you supposed first calculate your essential expenses for the month, make sure say you don settle am then use the remaining money, wey them Dey call discretionary or disposable money to take buy your Bitcoin.