Bitcoin investment na long time process, wey require to take gradual steps to build a good portfolio. Selling our bitcoin na de last thing after we don dey satisfy with our bitcoin portfolio. Them no dey rush do am or get quick profit mindset, according to oyibo " Rome was not built in a day" meaning take time do things something well.
Bitcoin volatility no de very high the way most alt coins own de so to get better profit person suppose really focus to build him portfolio fess before person go fit even think of him profit. To accumulate plenty profit you must de prepare to invest and hodl for a long time so if you wan invest for bitcoin you must put am for back of your mind say you go hold am for a long time and so throughout that time you go de use am build your portfolio, de accumulate more and more depending on the strategy wey you wan adopt.
Bitcoin investment, take long time before ee dey ripe well. People wey begin this bitcoin investment journey from beginning, na so them do am by building their bitcoin portfolio for long time and the them benefit like that. So we need to learn from dem build our own too for that kind period to profit also.
Normally the way bitcoin price don rise reach e de very difficult to get better profit if you no leave am for a long time, speculation don full everywhere say bitcoin go climb mountains say e go still de climb with time but with how e don behave in the past e sure say bitcoin price go rise wella even if it will take more years na why to hold and hodl for as long as you can na em be the best thing.