Bitcoin investment na long time process, wey require to take gradual steps to build a good portfolio. Selling our bitcoin na de last thing after we don dey satisfy with our bitcoin portfolio.
Every better investor no dey get satisfaction for em investment, as far say na na profitable investment, even when you don reach your target, you must dey greedy make you get more gains, so you go invest pass your target. No dey carry only your target for mind if you dey invest, instead carry am for mind to pass your target, so you go fit meet am come pass if possible, of you carry only your target for mind, you fit tire no come reach am.
Try dey set higher than normal goals for yourself, so you go get higher advantage.
Bitcoin investment, take long time before ee dey ripe well. People wey begin this bitcoin investment journey from beginning, na so them do am by building their bitcoin portfolio for long time and the them benefit like that. So we need to learn from dem build our own too for that kind period to profit also.
,but no be so, u need to build good portfolio small small with dollar cost Averaging (DCA) to gather bitcoin weekly or monthly for like 5 to 10 years ....... even more but depending on ur target before thinking of selling.
You fit still build your portfolio within a short time, them get lump sum, which be say you use plenty money buy BTC one time come dey hold am. Thst one ma for people wey get the big money. If you no get, you settle for DCA.