In a recent development, there is sad news about 200+ students currently trapped under a collapsed school building in Jos. The unfortunate incident happened today while innocent children were writing their examination in a school building that lacked basic structural integrity and was probably neglected by the government and allowed to house hundreds of students in it.
As I see the news the matter really pain me ooo, but dis one no be government I Dey blame alone for dis kin matter, Dey suppose arrest the engineer wey work for d building for not using quality matters, how you go collect contract to build and you no go do am well, and you know say na people life you Dey put at risk. D way buildings Dey even collapse for dis country now self Dey scary, something should be done about it, make government make sure say na quality materials dem Dey import, or produced in d country, also make contractors Dey use quality materials, make dem no Dey manage, and make people wey get projects make sure say na qualified people dem Dey give work.
If you've visited some public schools in some localities and looked at the crowd of students learning in an old two to three-story building that's half dead and yet still in use, you will weep for our dear nation.
If you see some public schools for dis country, you go just shake head, and you go see d way student go full class. I don’t really know Wetin our politicians Dey do, to renovate or build new schools na problem again, I don’t know d work of our local government chairman, our House of Representatives, our senators, things like this na dem suppose Dey handle am now, if dem start to Dey fix schools wey Dey under there constituency, we for no Dey see things like dis.