Binance left we survived,now is OKX's turn we will continue to survive.
I dey sure sey d condition wey owa anti-populist govment give OKX dey tough to manage. Na im go make d exchange knack out instead of to dey continue business wey nor go favour dem. I go wit wetin Igebotz' speculate for dat reason. As FGN or OKX nor open up to the public on the issue of the gbenge, e nor go pass tax on the issue if we judge how FGN brouhaha wit Binance dey go. D good news be sey govment nor fit kill d people's enthusiasm and participation for dis matta. No matta what, Nigerians go continue to dey find way to transact cryptos.
Again, e go dey good make Nigerians on dat exchange find way to stick to the August 16 date (that's where my target is at) to pull out their funds instead of the end of August to avoid stories wey go touch d heart later.