My people me I no even get plenty talk to talk again becos as e be so the major problem for this contri now nah Fuel price wey fly go where we no know and I no understand why things be as e be now. Abeg wan really know if this our oga richest man DANGOTE if him dey really fight for we Nigerians or him dey do all these for him pocket, I no just know where I wan place this thing.
Make una follow put mouth and address this matter...
Dis fuel matter just get as e be, because e just be like say both federal government and Dangote just Dey play us, and we no even sabi d one wey we even trust among the two of them, and if fuel price no come down for dis country, then cost of food prices no go come down, because everybody Dey complain say cost of transportation Dey very high, so if dem wan transport things from one place to another , d money wey dem Dey spend now don multiply so many times, and e be like say our baba no ready do anything.
How cost of petro go increase now wey we Dey refine d petrol for our side, and time wey we Dey import am, d price still Dey low that time, d matter just get as e be, and Dangote Dey claim say him wan help d country, but na government no just want make things work, and d government also Dey blame Dangote. Seriously make we just Dey observe, make we Dey look Wetin Dey go do.