Do you think there would quickly be a resolve between the Nigeria government and binance so easily after all this long fight they have not stii resolved. Come to talk of it, both parties have nothing to lose as they would benefit from whatever agreement they reach.
Settlement go slove everything, make we forget this Cho Cho Cho wey FG dey do. We all know as this country dey be, if Bob risky no go prison but dey apartment (for 3 months) instead of prison, anything dey possible with the right connect.
FG never end this matter because Binance never cooperates with them, I just dey blame this new CEO sha because if na the old one, things will be resolved since. This new CEO just belike him no want they comot money for hand but wants to make more instead, see as them just they list every memecoins wey come out. Make Binance press money, them too make money from Nigerians but now self the taxes no go do we Nigerians any good but na still the FG them go chop am when Binance done pay. Binance sha dey lose money wey them suppose they make with cooperating with the government.
The best thing is for Binance to pay and their workers will be released.
Binance sef get enough to benefit from the Nigeria Crypto market. Before binance stop the Nigeria p2p, Na their platform 99% of Nigeria Crypto community dey use for p2p trade and dem dey make money heavily from Nigerians wey dey use their platform for business. So to reason with Nigeria government and pay tax no suppose be their palava because them.don make serious money from Nigerians wey dey use their platform.
As for their official wey dey government custody, na binance make am still dey there because I no see any reason wey binance go give wey make dem no fit reason with the government. If na CZ, I believe say dem for don die this matter tey tey and business for dey go on and each party dey get their own cut as agreed.
As for our government, we already know why dem dey chook eye dey press for the tax because na dem go gabadus the money. Dem never tire to pack money, dem no mind whatever e go cost dem to get that money out from binance as long as the official still dey with them, Na 50 50 for them.