Shabi Hamster Kombat dun do them small bad thing, after all the tapping withing them give una again?
Na so e go be when you go lose the small one wey dey your wallet because say you dey find new ones through tapping. Incase you don't know, downloading an infected app can give them access to your phone and then fit enter any where them wan access.
No be every tapping you go tap. Some you go just get to ignore them even though e be like say everybody they do am. Infact wetin me dey tell myself say, if plenty people too know am, e no worth am again but Bitcoin no follow for this talk oh.
Omo many people expectations been cut short, most of them wey done dey reason to use their Hampster Kombat money buy benz na so so complain complain dey just dey complain online, wetin funny na say these people been dey see themselves as CEO, person say em be Lord for Hampster Kombat say em mine up to 1 billion HMSTR Token and when eh launch eh go buy this and that omo Hampster launch, they give am just $6, very funny. That's why people no supposed dey take most of those airdrops projects wey dey launch for Ton blockchain seriously cause just like Hampster, Catizen and some others, them no really dey sincere to their community and dey make people waste their precious time. However wetin the OP dey reason dey very important and na something to ponder about cause since the Ton Blockchain come out you go dey see different links of airdrops lately and eh dey possible say many of them contain malware wey fit give scammers access to people privacy cause Telegram na scammers ground.