Good evening my fellow country people. How una Dey as e Dey hot we all go don see the video wey Dey trend between fct Minister and the naval officer wey them Dey drag matter because of land.
Na why I come here make I come give my own view of the matter and make I here from una too.
As I reason the matter I really commend the officer because him handled the matter professionally he try by every possible wey to protect the uniform wey him wear.
Secondly why wike go oven call am a fool when him no say na decorated officer him Dey follow yarn.
I knw say una go don see the video make I hear wetin be one own view as for me the officer do the right thing as him no gree make any politician disrespect him uniform.
I like how the military officer handle the matter, em no shout or dey aggressive like wike wey no fit respect em age and office the officer reply back professionally. Wetin Wike no know na say the military uniform na symbol of respect and him wey be wike despite em position disrespect the uniform, I wonder if em dey expect say a military personnel wey dey act according to orders from em oga go fear or take orders from am.
Well, for Nigerian constitution (section 218) na only the president as Commander- in - Chief of Armed forces get the authority to command military personnel, Wike no get that authority, cause em no be soldier, eh just be civilian Minister outside defence and that soldier they follow order from em superior and whether em superior dey retired or not order na order and he must obey the last command, wetin wike supposed do na to seek help from presidency or defence minister but eh wan show say eh get power, but eh backfire am. Well Nigeria na lawless country so I no go suprise if them send that officer go Sambisa forest.