I think e Dey hard, even as buying the dip sounds easy in theory, but when the charts don start bleeding in real time, emotions go come enter, which nor go come let person do Watin he suppose do.. Fear, doubt, second guessing…
all of that Dey makes people hesitate.. Even people were claim say dem be long term holders go suddenly start panicking when the red candles keep coming.. The Mind go Dey doubt if this dip go ever stop. Buying the dip na really psychological game more than any strategy..
If to say na bitcoin you dey talk about buying the dip, that one no be problem, if na alt, abeg, me no follow you talk that one. Me personally, I don reach that place in my emotions wey nothing go shake me again in the space, I don dey experience many dips and many rise sotey I don strong in my emotions.
Wetin I dey always dey pray be say, make I get Fiat with me whenever the price dips make I for fit purchase more at every dip, cos e go hard to practice wetin you dey talk when Fiat no dey come at all.
As Fiat dey come make you buy rapidly, weda rise or dip.